TRENDING 'WORD'

in #naijapidgin6 years ago

Ma Naija people how una dey, I trowey salute give una oooo.
And I welcome all of una to our ogbonge naijapidgin blog.

As una know say Monday dey carry different swag diferrent effizy. So as it go be today, na street we wan enter, we wan see abi hear dat koko thing wey dey sup for una street. Make una just dey follow me as I dey talk am.

IMG_20180312_092725_001.jpg
As the topic don dey, I know say we fit no understand am wella.
So wetin d topic dey yarn us about be say: wetin be dat word, dat one word wey dey trend for una street, it fit be your house or una community.
Wetin be dat koko word wey everyone dey talk.....

@naijapidgin entry..

As I dey think am like this, I know say plenty people go don know this word...
Sha Pra Pra....
Na this single word dey trend for ma area as u dey read dis post like dis. As I fit translate dis word, hmmn, na just to say ' the thing dey hot for una body'

So wetin we wan make una do

U go just waka to d comment zone.
Make una post ur entry for dat word wey dey trend, wey dey shake all una street and how u take understand d word..
The word fit be our lingual franca and it fit be ur street or una community language..

All eligible entries fit win something........

Make una come join us for our Whatsapp group by 9pm
If u neba join click here

Na @horlaide create dis post for naijapidgin

IMG_20180223_122656_371.jpg
Avatar designed by @mittymartz

Sort:  

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.14
JST 0.030
BTC 59479.71
ETH 3174.48
USDT 1.00
SBD 2.44