SIGN FOR DOMESTIC VIOLENCE

in #naijapidgin6 years ago


source

My pipo my pipo,
How una dey? How una dey take hold body for dis weather?

Today na friday, i know say una don dey jolly.. I wan make we reason Domestic Violence matter today.

Wetin be dis Domestic violence sef?

Domestic violence na wen person wey dey relationship dey abuse e partner.. E fit be Physical abuse wey be say the person dey beat am up and down. Or Emotional abuse/Psychological abuse wey be say the person dey talk to am anyhow so tey the partner no go come believe e self again, come dey do like mumu, the person go dey feel worthless. Or Sexual abuse wey be say the person go dey force e partner to do wetin e no wan do. The problem be say people no dey look well to know if the person wey dem dey love fit dey violent, dey go just dey love dey go, na after dey don marry wey casala go burst their eyes come open.

How we fit know if our partner go dey violent? Wetin be d sign?

  • If e no dey give you space
    People wey fit dey violent dey like power well well. If your partner no dey give you space, e wan know where you dey every minute, who you dey talk to every second, e no dey gree commot, e no want make you dey see your friends, e want make e be d only person wey you dey talk to, my broda my sista check am well, no be love.

  • E dey insult your body
    My broda my sista no be you create yourself o, if person no like your body make e leave. If your partner dey always abuse your body, dey always use mouth finish you, ask yourself how you dey wen e meet you. Even if you dey try do your body well, e fit be say you fat, your partner go wan manipulate you so tey you hate yourself, abeg just kukuma commot, this one na Emotional abuse.

  • E dey make you feel worthless
    If person dey make you feel like say you no get talent, or you no get sense, you no go fit achieve anything for your life, na so you go dey do like mumu. If your partner dey always insult your work or your skill or wetin you dey talk, come dey call you names, na because say e like power and e no wan give you space to better pass am so that e go fit dey control you. Wetin you still dey do for the relationship? Your partner suppose dey encourage you, and e no sup[ose fear your success.

  • E dey always blame you
    If your partner dey always blame you for any quarrel wey una get, or for anything wey happen, no be better person. E no dey talk sorry, instead e go twist matter put for your head so that you go dey beg, one day if you no beg am, e fit slap you. If you see this sign, start to dey reason your matter.

  • E dey make you fear
    If your partner dey always threaten you, e fit no be to beat you but e fit dey threaten you with another thing, that one na better sign o. As far as e dey put fear for your body, no be better person.

  • E dey treat you like maid
    If your partner no dey gree make you talk for the relationship, e no good. E go dey dey make all the decision wey dey the relationship like say na your papa or mama, that one dey show say e like too much power.

One thing wey dey common for people wey dey violent be say dem dey control and manipulate their partner, and if you no do wetin dey want, dey go begin abuse you, na so Domestic Violence dey start.

The signs plenty but i go stop here today, so i wan open floor make everybody talk their own for comment section. If you don get any experience you fit share make we learn.

Na @nmalove carry this matter come

Footnote

If you would like to support us,

Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows

Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

[Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Steemit Diary + Amebo with @rebeccafl [Fridays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapodgin Team:

The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...

@ogoowinner

@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde

IMG_20180319_092844_398.jpg

Avatar designed by @mittymartz

Sort:  

The worst naa that emotional and psychological abuse. The person go just feel worthless with a very low self esteem.

That one bad pass, the person no go get morale to commot for the relationship

Yes o my sister

Domestic violence no be beta thing o e dey affect person well well

domestic violence na bad tin o

Very bad e no good o

Una don hear am my country people. Make we join hand fight this demon wey Dem dey call domestic violence. If you see any of this sign abegmake you run for your life.

Tuama make the race no get part 2 you talk well my dear

Domestic violence na crime. Mey we join hand eradicate tam....nice campaign @naijapidgin

Thank you my dear

Violence everywhere in the world
Se na life be dis, make person sha dey do jeje

Coin Marketplace

STEEM 0.28
TRX 0.12
JST 0.033
BTC 69488.13
ETH 3501.35
USDT 1.00
SBD 3.69