Naijapidgin hotseat with @ogoowinner

in #naijapidgin6 years ago

image
My country people. Una good morning o. Finally weekend don show face. Hope una enjoy una week? Today for naijapidgin we want do something different. We decide to bring una our own mama, our own person wey get @naijapidgin blog make she follow us yarn today. So today for we house, we get @ogoowinner for our naija hot seat. Abeg make una clap hand welcome am. @ogowinner, welcome o

Oya trowey salute for your country people

Ogoowinner:
My people I hail o

Naijapidgin:
She dey hail una o. Una don hear?
Now we want know who @ogoowinner be. E Don tey wey this question dey people mind. Tell us today who be this @ogoowinner?

Ogoowinner:
OK o, I be one better pikin wey my mama born for Kaduna but I from Eastern part of Nigeria. My real name na ogochukwu

Naijapidgin:
Hmmm kaduna? Na im be say you dey chew hausa?

Ogoowinner:
Small small
Lol!

Naijapidgin:
Okay na that one na im make you naija daughter

Ogoowinner:
Yeah, I understand Yoruba small sef.

Naijapidgin:
Ehen we know say you don be don for this steemit mata but we still know say dey no born you born steemit 😁😁 so abeg yarn us, how you take hear about steemit

Ogoowinner:
Na one fake facebook account for my friends list tell me about steemit o! I just make post ask wetin person fit do earn money online, na ein him send me the link.

Naijapidgin:
You see how fake Facebook account take beta your life so?

Ogoowinner:
My sister na God o! Lol

Naijapidgin:
Hehehe na this kind luck we dey pray for always o.
So as you start this steemit Waka, na immediately your post begin dey hammer dey get plenty plenty upvote abi abeg yarn us how the journey be and the first time wey you see $1 for your post

Ogoowinner:
Yes. My first post make money, the same thing with the second one. But after then, I begin see 0.00. Lol
Until ein later pick up again

Naijapidgin:
😂 na im be say all of us na im must pass this 0.00 levels. God dey. Steemit that time wey you join and now, any difference?

Ogoowinner:
That time sweet pass now sha, because people never plenty. So everybody dey do like brothers and sisters

Naijapidgin:
No be lie. now people don full yakata for steemit, nobody know anybody again. This na good thing abi na bad thing?

Ogoowinner:
Na good thing sha Because we all dey pray make steemit become the number social media

Naijapidgin:
Amen o

You go advice person make e close him bank account, resign for him job carry everything wey he get put for steemit make an the main place wey e go take dey get money, wetin oyibo dey call "primary source of income?"

Ogoowinner:
Noo.Never!

Naijapidgin:
Una don hear am? She talk say "never"

Ogoowinner:
No matter how much we you dey get from steemit, still get wetin you dey do offline

Naijapidgin:
Gbam.

Better talk

Okay o. Na this one bring me to my next question. Recently, they say crypto dey bleed, I no know weda na red blood e dey bleed abi na water before you know na so the price of SBD and Steem come just dey fall like breast of woman wey don born twenty children, we try to hold am for where. People liver just dey cut. Some people pack their load say they no steem again.

Abeg wetin dey cause the fall in price?

Ogoowinner:
Everything wey go up must come down. Na normal something And I know say ein go still go up again
Market dey always fluctuate

Naijapidgin:
Una hear am. She say the fall na normal something so make afraid no catch una. Make una still dey steem dey visit naijapidgin blog 😄

@ogoowinner wetin you go talk say na im be post wey dey exceptional? Na as e long teach abi na the number of picture wey dey inside?

Ogoowinner:
Me I think say na the originality of the post and the way wey the writer take capture the mind of him readers. Long or short no matter

Naijapidgin:
Okay o

Wednesday wey pass na your birthday and we for naijapidgin celebrate you well well. How that day be for you as you see people dey celebrate you everywhere as our steemit celebrity?

Ogoowinner:
Nothing much. I thank all of una.

Naijapidgin:
We thank you do. Na you do well pass

We for naijapidgin happy as you make out time join us this morning for our show naijapidgin blog

But before you go, translate this thing for Queen's English for us

"wetin dey puyeke for here, everybody just dey shayo?"

Ogoowinner:
Chisos!

Naijapidgin:
😂

Ogoowinner:
Walahi I no even know wetin ein mean

😂

Naijapidgin:
😂😂😂

No be small thing. That na assignment for you

Ogoowinner:
OK na! I go submit am next year
Happy birthday to steemit
Today steemit go make two years

Naijapidgin:
Tomorrow Sunday abi today Saturday?

No be small thing o. Okay now we for @naijapidgin dey wish steemit happy birthday o

Ogoowinner:
Today na Saturday. 24th March

Naijapidgin:
My country people una don hear am from @ogoowinner. Everything wey you suppose know she don answer. If you get question, you fit ask for comment section.

@ogoowinner you do well grace this our hotseat o. Hope the seat no too hot? Wetin be the final words wey you go tell your people?

Ogoowinner:
I want beg them make them continue to support the naijapidgin account. And make them continue to dey fly naija flag well well for steemit.

Naijapidgin:
Yes o. Make una continue dey fly the naija flag well for steemit o

We don come to the end of this show. If you go like find out more, join our WhatsApp group for this link

Na @zizymena do this one for @naijapidgin

image

Na @mittymartz design we avatar.
Sort:  

You be correct "nwada", we all for Alaigbo throway salute to you for making us all proud.

As a daughter of the soil, we wey be elders council don gree to give you chieftaincy title of 'Ada Steemit 1' on obodo Naija.
When next you come East, we go crown you.

Thanks @naijapidgin for bringing our nwada @ogoowinner to the hotseat.

@ogoowinner humble and true always, na wetin make am special well well, she na voice to even people we no get voice, she follow me yarn wella when I first come here, even when I no sabi anybody or belong to any group.

I no know say dem born am for ugwu Hausa o
abeg, tuale for her o my everyday woman crush for here,
no make me emotional for here, I no fit talk everything, day go dark, day go break

@ogoowinner u be one of the few people for this world wey get golden heart u tooo much

@ogoowinner u too dey do fake Facebook account lol. Na U make Steemit fun for me, we even dey free to express ourselves wella.
I no even know say u na WAZOBIA pikin, I only Sabi Yoruba and small Igbo. @ogoowinner u too much

@ogoowinner thank you o as you don clear us on one or two matters
God go bless you

Interesting interview
I seriously couldn't even translate that to Queen's English
The grammar na correct Adjectival Clause for Pidgin...Lol!!

Better interview. So @Ogoowinner sef see $0.00 for steemit? This one just show say no be everybody wey you see dey earn big naim start that way. People don't pay the price to fetch where den dey.

@ogoowiner make the interview hot
I no dey waste time I dey follow you up 😀

@ogoowinner 🤔 what a blessing to the world!

Naijapidginators wetin dey puye puye
I hail una no b small, una dey erect
May una reason SBD come make I yarn una wetin puyeke mean

Coin Marketplace

STEEM 0.26
TRX 0.11
JST 0.033
BTC 64498.18
ETH 3079.08
USDT 1.00
SBD 3.86