NAIJAPIDGIN HOTSEAT EPISODE 2 WITH EWUOSO

in #naijapidgin6 years ago

Naijapidgin:
Good morning my naija people and we beautiful people of naijapidgin. How una dey? We trowey salute o. Today na another Saturday and as we do am last week we don carry am come again. Wetin I dey talk about? Na we naijapidgin hotseat. Yaay.

For today episode, our guest na the man himself, the person wey get the community wey Dem dey call steembeeshive. Make una join me as I welcome Mr @ewuoso. Mr @ewuoso. You welcome o. Salute our people
imagesource

Ewuoso:
Good evening my people. I salute una
Hope una day fine?

Naijapidgin:
I go answer for them because I sure say Dem dey fine. Yes o. As e dey hot. Abeg yarn us, who be @ewuoso?

Ewuoso:
E ma self sure say them go day fine. Today na Saturday na so dem go they one corner of a club day rock

Naijapidgin:
Hehehe no be lie. E be like say you na rocker.

Ewuoso:
Make I answer the question way you been ask me. Olusesi na name way my papa and mama bin name me. That Ewuoso na my surname. Na him I use register Steemit. Na why una know me as Ewuoso. My full name na Ewuoso Olusesi oluwaseyi.

Papa and mama bin do that thing come born me for Abeokuta Nigeria. My papa na person way like woman so hin marry two wives. My mama na the second wife.

Naijapidgin:
Hehehehehe I no fit laugh.

Ewuoso:
Ewuoso na one cute guy. Person way fear God well. Him school for tai solorain university of education where hin study economics. I bin finish my youth service April 2017, one way I do for kebbi state Nigeria

Naijapidgin:
No be small information you don give us for naijapidgin o. The whole steemit suppose come here today because they no go find this information for another place. Bros you do well

So una don hear everything about am o now we go ask am about steemit @ewuoso how you take first hear about steemit and when you take join?

Ewuoso:
Na so my sister. I no say some people don day wan ask me this tay tay but this na the opportunity for them

Naijapidgin:
We happy as na we blog you choose to throw this bomb give them. No be small honour you honour us

Ewuoso:
Na my elder brother bin introduce me to steemit. Him bin day tell me since oo but me no bin wan believe am because the thing day be like scam

Naijapidgin:
No be lie

Ewuoso:
But him no allow me rest na so I bin come try am out. I register June 2017. I no wan day serious at first sha. But now we day here

Naijapidgin:
And now we dey here. Hmm. you na baba now😄. Abeg wetin be the name of your elder bro for steemit and wetin be your first experience. Na sharp sharp your post begin dey hammer?

Ewuoso:
Na jammey bin hin name oo but jammey don travel

Naijapidgin:
Okay

Ewuoso:
As e be now him no day steemit

Naijapidgin:
Okay. Oya share your first experience. How e be for your first post. You ever get $0.00?

Ewuoso:
Chai e no easy oo my sister. When I start ehn I no day see shishi. But me self been day write rubbish sha

Naijapidgin:
😂😂😂

Ewuoso:
I bin don wan give up. I come see one Tory for Instagram. One girl bin day share her racism story na. I come write about am for Steemit. Like play like play person nack me 14$

Naijapidgin:
O boi😳😳 na there you believe steemit abi?

Ewuoso:
Sharparly since then na Steemit 24/7

Naijapidgin:
Hehehehe

Okay as e dey hot, make we ask you another question

Ewuoso:
I day wait ur question

Naijapidgin:
Steemit na full time job for you abi e get another thing wey you dey do?

Ewuoso:
I no go say na full time job like that but I get farm business way I day run

Naijapidgin:
Oh you na farmer? Interesting. How you take dey combine am with steemit because I know say farm business dey take person time wella?

Ewuoso:
E day hard ooo but I get person way I bin employ put for there. Na him day run am for me. I just day go check m

Naijapidgin:
Okay make e for no go spoil.

Ewuoso:
But no be every time. U see am ba
Farm day require attention wella

Naijapidgin:
Okay for we naija community everybody sabi you because you na Nigerian curator. Abeg yarn us how you take become Nigerian curator?

Ewuoso:
E no easy ooo. Na online I been see the thing now say make we apply. I bin don day try am.since but them be no pick me na. But I bin no give up. If person wan be curator for curie u ho need follow top curator talk. Dem go test u so if you pass dem go pick u. Na so the thing be

Naijapidgin:
No be small thing o. Choi. Hmmm. E no easy o

Ewuoso:
I come message @monajam one day like that, the woman bin come test me now. I come pass the test so she come pick me
Na money be the delegation thing ooo. Na the easier way be that..if you get your money for hand today you go get am sharp Sharp

Naijapidgin:
Okay. We dey hear about delegate SP upandan. Everybody dey find am and we know say you Sabi the secret how to get am. Abeg share am with us

Ewuoso:
But if you no get money now, you fit win m. Person fit like you see say you day do well come dash you. I don win like 3 times now sha

Naijapidgin:
3 times?😳

Ewuoso:
Spotlight anomadsol and make a minnow

Naijapidgin:
👏👏👏👏👏

Ewuoso:
All of them don collect am back

Naijapidgin:
But at least you win am

Ewuoso:
Yes

Naijapidgin:
Okay wetin be your advice to minnow. Wetin Dem go do to grow sharp sharp for steemit?

Ewuoso:
Sharp sharp no be the thing na. Make dem do m jejely. Make dem just try mingle for the platform na. Na watn him suppose be be that.

Naijapidgin:
Minnows una dey hear so?

Ewuoso:
If una day reason say you go just come pack the money run. You no go see anything

Naijapidgin:
Gbagam.

Ewuoso:
A post and 30 comments per day go do the trick

Naijapidgin:
Okay now. E don give una formula. A post and 30 comments per day go do the trick. Steemit no be for lazy person

Bros make I cough first because wetin I want ask you now strong 😚

Ewuoso:
When I bin start I no day sleep. I day day for discord channel where I day try make friends

Naijapidgin:
Okay

You hustle no be small

One small bird tell us say your babe as in your woman dey steemit. Na true talk abi you na single and very available?

Ewuoso:
The bird no tell lie ooo. I get one wonderful woman for Steemit. Na my life and my happiness. She fit fight for me and she like me die.

Naijapidgin:
Chai. You don break many babe Dem heart wey be dey eye you even my own but nothing spoil Sha. We happy for you well. Invite us when rice set o

Ewuoso:
I hope say your heart no break sha.U no go vex noni

Naijapidgin:
E break into pieces😭😭
Which advise you get for us for naijapidgin?

Ewuoso:
The babe too wonderful. Na person way you know sha

Naijapidgin:
You go tell me after we finish this interview. Na for my eyes only 🤪

Ewuoso:
Na good thing una day do. As e be now I sure say one or two people be go don learn from watn I don yarn. So I go say tuale

Naijapidgin:
We don come to the end of this wonderful interview. Me sef learn no be small. You do well honour us as we call you but before we let you go, translate this one for Queen's English "Yam wey don done don done"

Ewuoso:
Yam that is well cooked is well cooked

Naijapidgin:
Correct👏👏👏 Bros na confirm. every level you dey there.

Ewuoso:
U get mouth na. U honour me as una call me for una interview

Naijapidgin:
We thank you o wella as you come today for we naijapidgin house o.

Ewuoso:
Na big hyping for me if u no no

Naijapidgin:
Wow. Na we happy pass. Oya no forget to help us reesteem o. People fit still drop questions for you o. At your own time abeg check an answer them o. We go appreciate am wella

Ewuoso:
I mad ni? Why I no go resteem m

Naijapidgin:
Better person. Chop knuckles🤛

My country people. Una don hear am from the horse's mouth o. Na @ewuoso na im be our ogbonge guest today. No be small thing he yarn us. We believe say you learn one or two things.

Until next week when we go come una way again, make una continue dey show naijapidgin love

Una bye bye o

Oya @ewuoso tell Dem bye bye

Ewuoso:
Una bye bye o. Make una no drink too much. And make una no forget to use durex.

My country people if you never join us for WhatsApp na long thing you dey o. Oya click here

na @zizymena na im run this one for for @naijapidgin

image

Na @mittymartz design this avatar for us.
Sort:  

Una good morning naijapidgin pipu
I gbadun this una interview. Abeg @ewuoso,you go yarn me small about minnows and delegate SP. I no sabi am because i no even fit understand how steemit dey run. I just dey post and I dey comment pipu post too

If na money you wan use get am, you fit check minnowbooster.net

Lol hahhah ewuoso self and you wan take where your papa come stop abi. Abeg no ask me wetin i mean....lol

Oya i day ask you papa

Wow
This is wonderful
I read every bit
Well-done to @naijapidgin for bringing the great @ewuoso on air. You did wonderfully well
@ewuoso no b one kind dull person, e no make the thing no dull at all. I just dey laff to myself for here. The way e take dey follow you yarn and answer una question dey interesting. The guy na clown, wey get the right word for the right questions. I hail you boss!!!!!

This one big gan oo. @naijapidgin una well-done oo. I trowey salute for una effort oo. @ewuoso, you break my heart no be small oo. I enjoy una Tori well well

I appreciate una as you call me come your interview. Naijapidgin na program way person suppose day check out all the time.

We appreciate you pass! Abeg chop knuckles!

This one na another ogbonge one from naijapidgin and Ewu baba...
Una do well

boss @ewuoso na correct nigga.. I enjoy this interview wella.

@ewuoso nor just well at all, which one be "nor forget to use Durex"?
Shey you their ambassador ni?

The name Ewuoso popular like glo, he dey paint everywhere green wherever he go. I don dey wait for this interview like person wey dey wait for im mama food to don.

Oga Ewuoso, socializing on discord no be beans nowadays, no body wan give anybody face except say the person na woman......

Abeg which kind tag person fit use, wey go fetch owo come out?

The way u talk about this babe, make i still find my missing rib for steemit.
But make e for no loss. I salute ur government

@yungchief, no be lie o. Nowadays to just make friend dey hard. You go message person sef dem no go reply. E taya me fa.
And as e be, now wet steemit don't dey crowded, minnows need person make dem take grow o.

Try to make friends. Magic no day baba nd errbody day hustle

Hehehe
No be small thing o
I no fit wait to meet this guy sha
Naijapidgin una too gbaski

Me self no fit wait

Oh boy see as i dey blush o
How e go come b na

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 62904.22
ETH 2571.38
USDT 1.00
SBD 2.76