NAIJA PIDGIN HOT SEAT WITH @CEEPEE- EPISODE 5

in #naijapidgin6 years ago

Naijapidgin:
dancing to fia fia by Davido my country people Dem dey talk say bring suya bring suya na nama body dey hear am. Nothing for this life easy and we no go hustle make another man run our race. With this one, I dey say a very big good morning to all of una wey don tune in to our Saturday ogbonge show wey we dey call "naija hot seat". E no easy o. This na episode 5. Abeg make una clap for una self. In case you miss last week, na our oga @ehiboss na him siddon for this hot seat and he make am coolee. Today my people, na one wonderful lady we get today for we studio

Abeg make una join me as I welcome @ceepee the beautiful crypto investor for steemit to our show today. @ceepee you are welcome. Abeg talk make our people hear this your sweet voice wey I don dey hear since😁
image>>>
@ceepee:
My people I dey hail oo, how parole

Naijapidgin:
See as your voice cool. This kind voice fit make person sleep inside heat😁

@ceepee:
Lol....abeg mek sleep no come ooh, na morning we dey oo

Naijapidgin:
Hehehe....no we no go sleep. Matter dey ground wey we go chew

Okay @ceepee, abeg tell us, who be @ceepee?

@ceepee:
Hehehehehe....who be ceepee? Dat na very expensive question oo, you sure say you go fit pay for am?
Anyway, ceepee na one small girl like day when people dey mistake for a man and she like am like dat

Naijapidgin:
Abeg still tell us small thing join now. You know say you na mystery wey people want solve. Make naijapidgin find out small now😁 oya you be Nigerian? Where you from for naija?

@ceepee:
Hmmm....that matter ehn!! I sha dey like mystery. I be full flesh naija babe oo, confam waffi water na them take baf me. So I be naija like you.

Naijapidgin:
Okokobioko. You mean say na Delta babe you be? Una don hear am? I open both eyes and nose for here. Na here una first hear am o say @ceepee na waffi babe.

Area! How far now

@ceepee:
I dey kamkpe, as per waffi no dey carry last

Naijapidgin:
Na so. We no dey carry last. Okay as e dey hot, them say make I ask you say this your name @ceepee, how you take come about am?

@ceepee:
Dat name ehn, na from Capt P I get am. Capt-cee and Precious-pee. Capt P na name when them dey call me from my work place. Na so the name just gum me, sotay, I dey almost forget say my real name na Precious

Naijapidgin:
Finally she don tell us her real name😉. I go come to work wey you dey do but before then, I want ask you, when you take join steemit and how your journey be for steemit so far?

@ceepee:
I join steemit last year june. Infact, wen I hear of steemit, I dey laugh say, me wen no sabi write, how I want take post for steemit. But, so far, steemit bringout the writing talent in me, sotay, I no believe myself.
My journey for steemit dey sweet oo. I don meet very wonderful people for steemit when be like say I don know them forever.
Make I use this opportunity appreciate those people when give me leg for steemit, @ehiboss, @infovore, @dreamchasser, @turpsy, @donkeypong. Na them teach me and groom me on steemit. Na so my journey so far be,y people

Naijapidgin:
You don tey small for steemit. As you take laugh na so many of us take laugh but see all of us today. So make I ask the journey smooth from beginning abi e get the time wey you almost give up?

@ceepee:
The journey no smooth oo, but I be dey one small group then, we dey rent sp to support each other. So them really make me enjoy the fun. But to talk true, I dey tire to post, sometimes I no dey get wetin to write sef. E get times when I go wan give up cos nothing to post, but thank God for these my mentors, them dey my back so no room for give up.

Naijapidgin:
Wow. Meaning for steemit we need mentors and people we go dey ginger us when e be like say our fuel want finish. Una don hear am o. Steemit no be one man journey

Ehen rubs hand together we know say you get one exchange company wey Dem dey call McCoy. Wetin inspire you to start am?

@ceepee:
See ehn, me I be crypto trader, long before I join steemit. I dey buy btc well well. As e con be say, sometimes btc dey had to get. As sharp babe na, I reason say if I dey buy steem/sbd, I fit convert to btc and that go help boost my supply of btc. So na wetin inspire am be that oo, my dear.

Naijapidgin:
Hehehe you na better waffi babe. You no dey carry last at all. Ehen my people so if you get SBD/steem abi btc and im broda, just find McCoy exchange buy for their hand. Their prices na ogbonge price wey you fit trust

@ceepee if I want become crypto investor, wetin you go advise me. How much I go need to start?

@ceepee:
Hmmm....my advice be say, start with wetin you fit afford to loose(spare money), cos if you wait till you get the big money, you go wait long. Since steem never too cost, you fit start with investing on steem. For me ooo, I dey like where I know say my money dey safe, so I no dey carry buy coins or follow ICO up and down. For now na just steem and btc be my major investment. But DYOR(do your own research) before you invest ooo

Naijapidgin:
This one na strong advise o. The summary be say, if you want invest, invest for where you sure say dey safe

@ceepee:
Na so my dear.

Naijapidgin:
Recently steemit don get many newcomers and na so dem dey cry upandan say them no dey get upvote, after all the better post wey dey sweat write. Many of them don even stop to post. Abeg make you advise them

@ceepee:
My advise be say, make them no too look payout. Make them join one community dey catch fun there, interact and make friends. My believe be say, steemit no go remain like this, plans dey on ground to support good writer with better content. So make we all dey patient. Me sef feel that way when I first start, but small small, things dey change. Make them also no relent on the quality of their post, one day na one day

Naijapidgin:
Our people dey talk am say na patient dog na him dey chop the fattest bone. The wise lady don talk o. who get ear make e hear

We don come to the end of today hotseat show. E dey pain me because I no want let you go. I dey feel you die but I know say na morning be market and you na busy person so I no get choice but before I leave you, abeg you go do two things for me

Tell our naijapidgin people where you dey work and why dem dey call you Captain

@ceepee:
Ok

I dey work for aviation industry as pilot, na why them dey call me Captain

Naijapidgin:
Omoh naija babe wey be pilot

@ceepee:
Thank you naijapigin, me sef feel una die

Naijapidgin:
We raise hand for you o babe. E no easy to see woman pilot e come be our own naija pikin. Abeg continue dey make us proud

@ceepee:
I go try as God get my back kamkpe...

Naijapidgin:
The last thing wey I want make you do for us na make you talk your favourite pidgin proverb make we still learn from am😁

@ceepee:
Hehehehe.....my pidgin proverb get as e be oo.
"Na today ikebe get centre parting?"

Naijapidgin:
Hehehe....you too Sabi abeg chop knuckles 👊

@ceepee:
Make me sef give you double knuckle chop🤜🤛

Naijapidgin:
With this, we don come to the end of your favourite naijapidgin hotseat. We enjoy am and we believe say una enjoy am too. Na @ceepee na im honour us today for we show. @ceepee thank you. We enjoy you. Oya tell naijapidgin your last word

@ceepee:
Naijapidgin, una well done oo, the first time I visit una blog, body sweet me wella, on to say our correct number 1 naija language dey for international social media dey make waves. Abeg make una continue to make us proud.
To all the naijapidgin team, I tuale for una.

Naijapidgin:

We tuale for you too. You do well come. Oya go make we serve you breakfast. Na here we draw the curtain o. If you never join us for we WhatsApp group you dey miss o, click here to join

Na @zizymena na im run this one for @naijapidgin.

image

Na @mittymartz na im design we avatar.

Sort:  

Nice interview here with @ceepee really enjoyed it haha...so she be pilot sef😂😂😂 issoryt @naijapidgin welldone oo....i dey feel una

Thanks @amec. Thought you knew.

Hahahah...Madam @ceepee, so you dey nack pidgin like this, meanwhile na only english we dey here you speak. This your proverb sha, dey do me grigri for body. Area!!!! One love sis, we be we we.

As if you no know....abeg carry yoursef dey go. Wetin do my proverb? Thanks dear.

Naijapidgin, una too much aswear. The ceepee when me know, no go grant any interview. @zizymena, you put jazz for mouth talk to her? Shuoo....the ceepee when I know, her privacy na another level. Mesef dey suspect her( she go kii me if she see this comment)

Zizy na sweet girl na. Who can refuse a sweet girl?

chia this one kill me
@ceepee you be correct babe ooo

Thanks plenty, na you correct pass sef.

lol.... How he come feel like to be air force personnel na... Hope say you nor go beat your husband or boyfriend ooo
lol

So @ceepee an girl OMG na pilot she even be oh...... Naijapidgin una try. Capt p I dab for you.

Thank you bro. I am loyal

Wow! Having a pilot as a fellow steemian is very cool! Nice one @naijapidgin... This is a great way to know more about great steemians

Thanks, we just gat to learn to do other things other than just flying.

Nice interview @ceepee the Captian P herself. We wey know you, we know haha.

Hahahaha....my boss, I am always loyal.

Naija pidgin Una dey try Gan make Una keep am up

They are awesome.

Omo i dey feel this babe @ceepee
Naija get correct people oo

Babe, I dey feel you too. Thanks for the comment.

Wch pics lolx.....its better not to comment at all than to spam

Yea it is
Especially the part with reg flag... 😊

Hahahaha. Guys no get joy at all

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 63099.62
ETH 2555.59
USDT 1.00
SBD 2.83