Na We Be Naija!

in #naijapidgin6 years ago

Ahmed-Musa.jpg
we naija

Goal! Goal!! Goal!!!
My pipu oo, i still dey hear am from inside my sleep ooo.
I hail una this jolly morning wey God take bless Naija, as e be say na weekend, naija tear iceland better 2-0 yesterday and weather come coole this morning, e be like say na heaven i dey oo.

The way belle take sweet the whole country yesterday, e make me remember when dem give us independence as we take jubilate. Everybody sabi say Naija na correct football country for we Africa but as somethings come dey happen for these years wey pass, pipo com dey comot mind for Naija, even me sef come tire as e be say dem match fit gibe person high BP but i come see say na because we love we country na why we dey always feel like dat.
Even tho say the first world cup match no try as everybody vex, Yesterday wey we win just make evrybody belle sweet, we come dey get mind for we own country, pipo for social media sef dey claim say dem be naija. Even me sef wey be @naijapidgin person for Russia here, i dey prouding ma wetin make me trowey this better gist.

749px-Nigeria_flag_map.svg.png[Original Naija]

I come see say naija people never happy for long time, different bad things for we country don make people lose joy but as we win yesterday come see the whole we conuntry dey celebrate, I no sabi where we go reach for this cup o, but make first celebrate this one first.
Abeg trowey your own jolly salute for comment section.

Na we be Naijapidgin!
Na Spirit of Naija!!
Na we be Naija!!!


Footnote

If you would like to support us,
Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows


Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

  • Real-Life Talk with @preciousimo
    [Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapidgin Team:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain:
@ogoowinner
@akintunde
@zizymena
@oliverwilliams
@horlaide
@mittymartz
@nmalove
@preciousimo
@rosyblessing


Na @mittymartz design this avatar

Na your boy @preciousimo bring this one today oo.

Sort:  

God bless nigeria
God bless our football team
God bless MUSA.
MUSA
M:make
U:us
S:smile
A: again.
We are ready for the next match .

We really tried. Musa made us proud.

Yes o no b try I tell u

Na so... Little boys been make belle sweet me yesterday especially with the second half display...

The good thing be say so many Nigerians don get reason to smile. I just hope day the rest of the tournament go dey like this o

Yes ooo, i no say we go flog Argentina because our morale don high. lol

Yes o you go see wetin Dem go do Argentina with dis moral wey Dem don carry so

Infact ehn i jus happy yesterday, them try , this one go charge them up for Argentina match. Up naija ooo, we must qualify.

I dey tell u we must qualify o

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

It was a great match I'm so happy we won

No be small thing oo, wetin our boys do ehn, na wetin APC neva fit do. Them make all naija people happy for d same time. As body sweet me reach, Musa for President oo

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 63126.02
ETH 2553.49
USDT 1.00
SBD 2.78