HOW UNA FIT SUCCEED FOR THIS STEEMIT WEY WE DEY SO.

in #naijapidgin6 years ago (edited)

image

My country people, how una dey? Shey life dey treat una well, shey life no too hard for una side?

I don package one better gist, i say make i carry am come your domot, but before i give una full gist, make i tell una one quick tori.

Una fit remember when una join steemit? I remember wella, them tell me say if i dey write well, dey interact with people, say i go dey get plenty money from steemit. Trust me now, i put all my power for steemit, i dey there dey write post, dey post everytime. But wetin happen? Na so so 0.01$ i dey see for my posts, sometimes sef, i fit dey get $0.000 for post wey i spend hours on top. Small time, i don dey discouraged, steemit no dey do me for body like before.

If you experience wetin i experience for steemit before, siddon wella, because i wan yarn you how you go take succeed for this our steemit. If you don dey think say you want quit, say you no dey do again, make i quickly remind you say "person wey wan chop better gats work hard". This steemit wey we dey no be ponzi abi lottery, so you go need work small.
Oya sharp sharp, make we start:

  1. If you get extra money, abeg invest for steemit:

Look around you small, people wey dey make plenty money for steemit don put money for inside steemit before. Even if you no get money to invest for steemit, no dey cash out everything wey you make for steemit, dey put the money back to steemit, steady steady, your steem power go bam!!!

  1. Make una dey consistent:

If to say you go dey post everyday, stick to am. If na once weekly, stick to am, na lyk that people go know wetin you represent gan gan. I go also advice say make you dey post at least one time for 24 hours. If you dey consistent, people go notice you and na like that person go take blow.

  1. No dey copy person work:

This one na the easiest way to fail for steemit. If una notice, steemit no dey like copied work, if you dey copy person's work, you go loose followers, them steem cleaners go finish your account, you go poor for steemit in general.

  1. Take una community seriously:

Nobody fit love you more than the people wey come from your side abi people wey una dey do the same thing. We get plenty nigerian community wey you fit join. Join them, follow their account, follow them for discord, dey talk when others too dey talk. Communities like @genesisproject, @bigwaves, @naijapidjin, @wafrica, @steemjet, @steem-lagos; na open hand them go use welcome you. No believe say you too big to join community. Other communities like @curie, @artisangroup, @steemstem, @stemng, @photo.curator, them fit help you and make people know wetin you dey do gan gan.

  1. No dey tire to dey interact with posts:

Always dey comment, comment, comment. I go even advice say you go dey comment on 15 posts daily. If you dey do that every day, people go notice you, followers go increase, whales sef fit notice you. In fact sef, some people dey make plenty money on top comment more than post.

  1. Follow beta people:

Follow confirm people for steemit here, dey read their post wella, comment if the post sweet you...steemit go tire you if na so so rubbish dey your feed. But if to say na correct thing dey dey your feed, you sef go like read them, it go sweet you to comment.

  1. Dey curate post wella:

If you be minnow for steemit and all the post you dey upvote na so so whale posts, you fit no make plenty steem power. Upvote hot posts, wey never pass 30 minutes, if 30 minutes don pass, you fit still upvote but if to say na whale, your curation reward no go plenty reach the one wey you go get for upvoting minnows posts.
Na because say i love una and your progress for steemit go sweet me well, na why i dey share this tip with una. If una no understand some things wey i explain or you wan add to wetin i don talk, abeg drop comment, make all of us gather learn. This steemit wey we dey so, we go gather make this money.
Na @soorefunmi bring this gist come.

IMG_20180215_155325_695.jpg

Avarta design by @martymittz

Sort:  

This one make sense naa. I feeel for am and think say this go go a long way to help.

I happy say you like this post...we go gather make am for here 💪

Thank una for yarning us this tori...
You don dey too much
I know say the tori go help many

I happy say you feel the post dey useful to you and many people. You sef dey too much!

This your yan make sense die,I dey thank una for the encouragement this beta Monday morning...

Naija na we get am

I hope say you grab something for here. This steemit go work for all of us.

I like this post wella. The thing sweet me for belle. Oga kudos oo

I happy say this one sweet you.

This one really open my eyes... E make sense!!! Una weldone?!!!

Thank God this one open your eyes...no dull again o

Una try gan i feel this post make una keep on doing ya good works. Na we dey here

Na beta yarn be dis. Tank yo

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.13
JST 0.029
BTC 58720.84
ETH 3088.52
USDT 1.00
SBD 2.41