HOSPITAL ATTENDANT STEALS BABY PLACENTA FOR RITUALS

in #naijapidgin5 years ago


Source

Una weldone o..
TGIF!!

Pipo get bad mind no be small.. Eget one hospital attendant, Fatima SUleiman for Capstone Hospital, Ilorin Kwara State wey carry baby placenta give juju man, Salaudeen Ibrahim make e carry do charm..

Police people talk say as doctor born pikin finish for the patient, e carry the placenta give Fatima make e give the papa of the pikin wey dem born, but Fatima no give am e papa instead e carry am go sell to Juju man make e use am do ritual..

But as dey catch dem, the Juju man deny am. E talk say, fatima come meet am a month ago, ask am if e fit use placenta do ritual, e talk yes. She tell am say people wey born pikin for their hospital dey leave their placenta and dem dey throway am wella, say e go dey bring am come e shrine make e dey use am for ritual..

5 days ago, Fatima come drop this placenta wey dey cause wahala for e shrine, e come dey call am make e come carry the placenta, say e no wan do the ritual again because e mind no accept am.. Before you know it, fatima call am, tell am say police don catch am. As the juju man no wan implicate itself, e carry the placenta throway for river.

Fatima dey talk her own side, she talk say na the juju bin dey disturb am make e bring placenta for am. say e no gree but because say e be friends with the man wife, e gree, come carry dat placenta give am. Say e never do this kind thing for e life before.

My pipo make we dey careful o. Wicked people dey everyone. Na so person pikin go grow, come dey do anyhow, dey no know say person use e placenta do somethin wey e de small. Make we shine our eyes anywhere wey we dey..

Na @nmalove carry this matter come

If you like what the community is doing and would like to support us,

Please follow our trail via
Or delegate SP to @naijapidgin.

We are naijapidgin community with a mission to 'Promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows

Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On @naijapidgin discord channel, a lot of variety shows and lectures are ON

  • Every Tuesdays we have real life issues with @preciousimo
  • Every Wednesdays are unavoidable lectures
  • Every Thursday we have relationship talk with @sparkles
  • Fridays is our well known ameebo center by @rebeccafl
  • Sundays is always variety night show by @itoroarchibong and @imbigdee.
  • Same Sunday we have our @naijapidgin hotseat ( featuring some well known steemians)

You ought no to miss any of our programs.

TEAM:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
@ogoowinner
@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|

IMG_20180319_092844_398.jpg
Avatar designed by @mittymartz

Sort:  

@naijapidgin, thank you for using the naijapidgin tag.

We encourage and support minnows.

Join us on discord: https://discord.gg/5SR8CH4 for more fun and to submit your posts for curation.

You like what we are doing and would like to support us? Delegate SP to us Or Join our trail here: https://steemauto.com/dash.php?i=15&id=1&user=naijapidgin

Are you one of the lazy youths I've been hearing about?

Coin Marketplace

STEEM 0.30
TRX 0.12
JST 0.033
BTC 64513.89
ETH 3155.04
USDT 1.00
SBD 4.00