GRANDMAMA WEY KILL SMALL PIKIN

in #naijapidgin6 years ago

732977ffc42a74b05222be310bb3e652.jpg

Source
Happy weekend my pipo
Hope say una dey enjoy the weather wella.

No be small news wey i see this morning for instagram. I just dey reason the kind drama wey our politicians dey act since this week but na dis news weak me pass, so tey to cry come dey hungry me. Make i talk am, make una follow me reason am.

For Niger State, e get one 55years old grandmama wey dem dey call Aisha Ibrahim. The mama carry rope tie e granddaughter wey dey 2 years old throway for inside Well wey dey their compound for Karaya Fulani Camp. According to the grand mama, she kill the pikin to take punish the pikin mama wey be her daughter inlaw, say the pikin mama dey insult am wella. She talk say she born 12 children and dem dey live peacefully until her son Bello Ibrahim go marry the pikin mama, say she no go gree make she spoil the family wey she take sweat build. She come dey tell her husband make e tell their son make e divorce the daughter inlaw but e no gree.

The insult wey the pikin mama (daughter inlaw) dey give the grandmama don too pain am so tey she come dey reason how she go take punish am. Bello and e wife come go naming ceremony, leave the small girl for the grandmama, she come tie the pikin throway am for inside Well. Police people come trail am and arrest am as she dey try run. Now she dey regret wetin she do but the pikin don die.

Make una help me reason this matter.. No matter d insult wey d daughter inlaw dey give the woman, e reach to kill pikin wey no do anything?

The grand mama fit be the trouble maker because even her husband no gree listen to am wey she dey tell am say make dem pursue the daughter inlaw. Abi wetin una think?

Make una chook mouth for the matteroo, i wan hear una talk today

Na @nmalove carry this matter come una domot today..


If you like what the community is doing and would like to support us,

Please follow our trail via
Or delegate SP to @naijapidgin.

We are naijapidgin community with a mission to 'Promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows

Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On @naijapidgin discord channel, a lot of variety shows and lectures are ON

  • Every Tuesdays we have real life issues with @preciousimo
  • Every Wednesdays are unavoidable lectures
  • Every Thursday we have relationship talk with @sparkles
  • Fridays is our well known ameebo center by @rebeccafl
  • Sundays is always variety night show by @itoroarchibong and @imbigdee.
  • Same Sunday we have our @naijapidgin hotseat ( featuring some well known steemians)

You ought no to miss any of our programs.

TEAM:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
@ogoowinner
@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde

IMG_20180319_092844_398.jpg
Avatar designed by @mittymartz

Sort:  

Confirm idiot na him this grandma be o, I swear. Chai! Wey some people dey spend money to get na him grandmama go dey dash river. Shey na she enter craze nii abi na craze enter am?

But people stupid sha o... Oya chop knuckle for this one wey you bring @naijapidgin.

He be like say the mama get chin chin for head, why you go come kill your granddaughter because say in mama insult you. I fi carry that mama go hospital go check. Witch!!!

Una well done @naijapidgin. This one you carry come weak me o

No be small chin chin

con see as i open mouth wide so tey i no even no wetin i go talk so.

Na God go help us for this country and only God knows where this country is ending to.

@naijapidgin i hail una gann ooo
more power to una Elbow.

Na God go save us o

This one deep gan. Shey this woman fit make heaven like this sha?

Heaven for where!? Na she go lead us go hell bro

Nawa oo things just dey happen every day for niger but na mostly bad bad things wetin happen na. And wetin we go do

Na to dey pray o my broda

thanks for sharing

Congratulations @naijapidgin! You have completed the following achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of upvotes

Click on the badge to view your Board of Honor.
If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

Do you like SteemitBoard's project? Then Vote for its witness and get one more award!

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.13
JST 0.032
BTC 62513.70
ETH 2949.39
USDT 1.00
SBD 3.60