FG DON APPROVE ANAMBRA AS OIL PRODUCING STATE.

in #naijapidgin6 years ago

My country people una good morning. How una dey? This cold reach una side because e be like say na everywhere for we country this rain fall Sha. Rainy season don land again, make una dey carry umbrella and extra shoe Waka o. Remember how we road be for naija.

image
FG DON APPROVE ANAMBRA AS STATE WEY GET OIL
The matter wey we get for una today na the news wey dey make waves for we country. This morning I hear am say Federal government don confirm Anambra State as state wey dey produce oil. Na yesterday the national chairman of all the communities wey dey produce oil for naija talk am for onitsha for Anambra State. He also talk say Federal government don approve 10 modular refineries for the 11 States wey dey produce oil even Anambra wey just join

Emuh come still talk say FG don approve employment of 10,000 youths wey come from all these states wey oil boku for their land. No forget say sometimes ago na so Dem talk say Bornu get oil and uptil now we never hear of oil exploration for their land.

Hmm, my people, election na next year o.una sure say this one no be campaign strategy? Refinery no be bad thing Sha but government wey we know fit do all these things? All these jobs wey Dem dey promise abeg who e don reach im family?

Buhari don come again. How una reason this news?

If you never join us for WhatsApp where every better thing dey happen, oya click here

na @zizymena bring tis Tori for una

image

Na @mittymartz design we avatar

Sort:  

Dem no need to explore any oil for Anambra state. The north no wan touch their resources and dem wan finish south own. Shey na cow and food dem dey produce, we go give dem fowl and cassava make everything balance. No cheating.

Na anoda strategy to make anambra support am for 2019 election, dis one na Rochas thinking.

You too Sabi. Me I see am as strategy too. Them leave Bornu where dey claim say oil dey but na we own Dem want finish first.

Story that tears the pant
Nothing like that all na strategy
Make we vote them enter finish another story go enter abi no be naija

Oho but what if true true oil dey Anambra?

Oil fit dey true true but that employmrnt of youth own that one na white lie
I no believe am

Pidgin on Steemit wow! Its amazing. I'm a Nigerian based in Uganda and I have lots of Ugandan friends who would love pidgin English. They would love this post. @jaraumoses come and see this

Wetin we no go hear for this election season.. Make our youth open eye o if not na another gbese Naija go enter.

My sister na dis period we dey see Dem Dem go carry their many many promises dey come. Na now dey want create job for youths wey come from oil states. This one na really story wey dey tear pant.

No be small something now, even aba self get oil too oo,, anyways make una no worry our presido buhari go soon make oil dey fall like rain reach every state since election don reach.

Chai, FG and campaign lies be like 5 and 6.
Refineries? Employment for 10,000 youths?
OK na, my work na to watch them, no be politics again.

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

Buhari don declear to run for 2019. But i no know which race him want run for: if na marathon or long distance race

Them think say we be mumu, that youth employment na big fat lie , na campaign dem use am do, abeg make we wise up ,if you no get pvc go collect am sharp sharp , 2019 don de near ,make we use our hand commot kanda for our rice

First of all them they mad second of all them no get sense why them no talk this one since that buhari ehnn well it is well sha but all i know is the government always are i don't know how oo but they are always smarter than the people

They always device new strategies everytime.

In fact i go commot for niger go my village

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 63191.19
ETH 2615.47
USDT 1.00
SBD 2.73