COME JUDGE YOURSELF

in #naijapidgin6 years ago

I greet every naijapidgin personal person... Hope say una dey manage dis kind economy .
First of all make I greet una happy new month because this month na better tin go full am.

Fellow steemians, how hustle? We thank God say market don dey green small small, e go beta very soon. @naijapidgin dey wish unah a stress free day ahead.
IMG_20180501_100409_545.jpg
As today go be, we jex wan yarn one shikini mata, make d resolution mata jex dey move dey go. Hope say una neva forget dis year resolution abi?
I know say some pipu resolution go be make dem impregnate Otedola's daughter, lol.

As u all know say today wey be tuesday na d first day of d month of may, first day wey dey d second quarter of d year, so how d mata go be.
Shey una don fufil unah first quarter i. e first 3month resolution, wetin be dat thing wey u promise urself,
Na dis thing @naijapidgin carry come our domot today oo

I believe say una don acheive unah first quarter resolution. Dats good.
So fellow steemians, hope say una don d set unah 2nd quarter resolution. As for me, i don set my second quarter resolution, wey be say i don dey pray on top.

So wetin @naijapidgin want make una do be say make unah list unah 2nd part resolutions so dat wen june month don start, u go get d fullest cost to appraise ur self for dis post..

As una know wetin dey sup for we whatsapp group, so ur comments fit earn u something
If u neva join [click here](https://chat.whatsapp.com/C0Tbv4dXGxI7H4qwMl10Qs

na @mittymartz carry dis post come

Reviewed by @zizymena @nmalove @oliverwilliams @horlaide
IMG_20180319_092844_398.jpg

na @mittymartz design dis fine avartar give @naijapidgin

Sort:  

Happy new month o
Naija pidgin pipu

This na my own month as it's my birthday.
As regards resolutions, I don't make one.

I just pray and hope for the best.

Cheers

You have a minor misspelling in the following sentence:

*I believe say una don acheive unah first quarter resolution.
It should be achieve instead of acheive.

Abeg na pidgin, leave am like dat.

Hahahahaha
The bot no understand english

For this 2nd quarter, I wan hustle until I qualify to join person autoupvote and trail.
Make atleast 5 whales or dolphin dey upvote my post.
Get delegation to dey push people ministry forward

Abeg I key into this your plan o

Oya make the hustle start

Me don set my 2nd quarter resolution but I no go fit list am here ooo... My village people dey steemit...

Where Dem dey?

Make I call their names? 😒😒

My resolution, to be a better me.
To love more, forgive more, worry less and live life like all is gonna end the next mins.

I hail una @naijapidgin oo, una dey try and God go dey bless una well well

Confirm @naijapidgin this month go go well Weller

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

Good morning oo @naijapigin and happy new month to all of unah.
Month of May na my month oo, I rep 15th May 🙌.
My second part resolutions na, to go closer to God and to get admission.

For this second quarter ehn, the plan na to get one better investment offline. Make I get one correct shop. I no go fit release wetin I go dey sell but I dey work towards am.

And I dey hope say I make i commot for this minnow level.

Dis advice make sensi well we'll, we @newsnow go back go look inside buku, see wetin we go fit do for dis quarter.

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.13
JST 0.029
BTC 57946.22
ETH 3059.94
USDT 1.00
SBD 2.34