CHRISTAIN SAY DEM NO GREE AGAIN..

in #naijapidgin6 years ago

My country people I trowey ogbonge salute for unah!
How unah dey?
How unah take d hold body for dis we change wey still d touch everybody so?
I believe say everybody dey alright because baba God dey

So dis beautiful morning I bring unah greetings from all of us wey dey for @naijapidgin

Anywhere you dey wey you d read dis post I say GOOD MORNING GEE today nah another Wednesday and nah so work go continue...

unnamed (1).jpg

Today we don carry another ogbonge matter come we domot again so that we go fit chook mouth put yarn better based on how we dey always do before and I know say unah no go fall my hand

As d matter d be yesterday wey nah Tuesday nah him all d catholic Christian wey nah one denomination for christain wey dey we country match come outside come do protest based on d plenty plenty killings wae don d happen for we country and also d protest nah to mourn d 17 people wey Fulani herdsmen kill for benue state.

D protest d very peaceful and e happen for all d 36 state for we country although no be all d christain denomination go protest but e make sense base on say at least dem don do something

The message wey den carry go met we government nah simple and straight say make government stop all this killings wey dey happen for we country

As d protest happen plenty plenty talk come d full everywhere both for tv and internet self nah him I talk say make I carry dis one come based on community wey we be make we reason am.

Unah know say e don tey we dem don d kill people for we country and if something no happen dem fit finish us oo but baba God no go gree sha

So my people abeg unah think say nah d right thing nah him dem do so?
Abi Unah think say even as dem don match so our government go do something for the matter
Abi if you be leader wetin b d right thing we you go do?
Abeg make we chook mouth put for dis matta

no forget to d support us with your upvote comment and resteem so that we go fit d serve unah well

if you want join we discord make you enter here

nah @oliverwilliams bring dis one come

nah @mittymartz give dis fine avarta

IMG_20180215_155325_695.jpg

Sort:  

Congratulations @naijapidgin! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of comments

Click on any badge to view your own Board of Honor on SteemitBoard.

To support your work, I also upvoted your post!
For more information about SteemitBoard, click here

If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

Upvote this notification to help all Steemit users. Learn why here!

i be catholic and i happy say this kind of thing dey happen for my church,i for follow them waka yesterday but i just dey too tired and the place far,na ture we talk o,stop killing,proudly catholic

I follow d pray make we government hear we cry dis time stop d killings.
One Catholic one christain one nation

For me ba na the right thing to do bi dat, but e no still mean say the killing go just stop like that , we need to still the the remind we government say the killing do too much make dem do something about am na watin I feel be that

My brother you yarn well thank you say you put mouth for this matter

Una good morning for here o,i bin reason the mata say na only God fit deliver us because Him don talk for Bible say pipu go dey kill themselves and na the sign for end time be that.
The only prayer we go dey pray be say make God save us wey dey alive and make He put the right person wey go rule us well and stop all this kain killing. Na only God we fit call o

My sister big amen to your prayers o
Nah only God hand we dey but e no mean say we no go help ourselves small

Abeg dem really try for this one sha, e no easy to fit organize this kind tin way those Catholic people do.
Well i just hope this protest go get impact sha unlike other once

Dem say nah hope fit make man d live every day o so make we just d hope d hope d go

E better ooo as we catholic raise one mind up dey say no to innocent killings. At least dem go know say we still dey kamkpe....twale to @naijapidgin as dem bring diz matter up

E better as we talk o at least christain don start something

To me nah the right thing oo, b coz Dem need to know say we no like the thing way dey happen. We get life to live.
We no be animals, we be human beings.

I wish say nah all the churches go stand up together, weda Catholic or no Catholic, we all nah Christian.

Una good morning until this morning..

@uche-nna
I believe say the government dey see all dis kain thing, bt dem just dey pretend say their eyes dey close
Na only God fit abort all dis kain nonsense

Yes na only him..
And I pray he go chok eyes for this matter

Na only God fit save us for this country

Abi oo
Na onlt God fit be our savior for dis kain wahala

The protest na better thing o... I witness the mobilization of people for the Abuja and people really respond.

We do tire to dey watch these people they massacre our brothers and sisters for no reason and government no dey do anything... E don tire me sef...

We dey count number of people wey dey die daily like sey we dey Afghanistan.

This nonsense must stop o

@korexe
U don dey follow our bkog no be today
We dey see ur effort, and u don yarn beta for dis mata.

I appreciate the recognition o... Una do well...

Dis country nothing come out. Our leaders judt dey play politices with this herdsmen and farmers killings. Na God go help us

Amen
Na only God fit commot person from dis kain problem
U don yarn beta for dis mata.

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.13
JST 0.029
BTC 67402.68
ETH 3481.04
USDT 1.00
SBD 2.65