CESC FABREGAS DON LEAVE CHELSEA

in #naijapidgin6 years ago

Good morning my country people. How una dey? This na another Thursday on top naijapidgin. How una area be with all these dem primary elections and gun wey dem dey shoot like say na knockout for Christmas time? Politics for naija tire me and me no want shook mouth put for inside. Na im make am today so I say make I follow another line, sports line.
IMG-20181004-WA0000.jpg

Image source

Gbege dey for Chelsea as dey fit lose their midfielder wey him name be Cesc Fabregas. Fabregas no happy for Chelsea as ear dey hear am say he fit comot for Chelsea this summer. The young man wey from Spain neva play a single premier league since Sarri become manager for Chelsea Football Club. Na only two appearances he don make for the blues for cup games. Cesc Fabregas don try tire make Sarri give am starting point but for where. Him matter come be like the one wey village people shook hand put as Jorghino and Kovacic show face. Since premier league campaign start this season, my guy neva use leg kick ball, na so so bench dem dey bench am, Barkley come still climb on top of am for pecking order.

Spanish news gather say the former Arsenal midfielder time for Stamford Bridge don dey show green light as he no see any contract on top his table dey wait for am. Although Fabregas no rule out say he fit remain for West London till next season, he dey consider to go back to him country or he fit accept new challenge for MLS.

Fabregas don spend four years for Chelsea since he join am from Barcelona and he don follow them win two premier league titles, FA cup and league Cup.

Na @zyzymena nak una this tori

Footnote

**If you would like to support us,

Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.**

We are naijapidgin community with a mission to promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows


Join our discord server for fun, interactions and voice shows here

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

[Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapidgin Team:

The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain:

@ogoowinner

@zizymena

@oliverwilliams

@horlaide

@mittymartz

@nmalove

@preciousimo

@rosyblessing

Na @mittymartz design this avatar

Sort:  

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! We encourage and support quality contents and projects from the West African region.
Do you have a suggestion, concern or want to appear as a guest author on WAfrica, join our discord server and discuss with a member of our curation team.
Don't forget to join us every Sunday by 20:30GMT for our Sunday WAFRO party on our discord channel. Thank you.

Make him go... Chelsea don get many betta midfielders wey sabi

Kante
joginho
Barkley
Kovacic loftus cheek

Fabregas has played his part and given his all for the team but with football na managers dey determine who dey play, it's sad but that's how the game is.

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 62837.64
ETH 2542.11
USDT 1.00
SBD 2.65