BUHARI: NAIJA YOUTHS DEY LAZY

in #naijapidgin6 years ago (edited)


source

My people my people
Una weldone o..
Hope say una dey enjoy the weather, e be like say the market don dey smile small small
I hail una o.

Naija pidgin don carry ogbonge matter come again..

Today na Friday, i no wan talk politics today but i no fit close mouth for this matter wey I dey hear since this week, the thing tire me, infact the the dey vex me.

If we check wetin dey happen for our countri today, we go see say na we youths dey make the economy bubble, na youths dey do wetin oyibo dey call entrepreneurship, employ people put. Na youths dey hustle and all our hustle dey make our economy bubble.. Check Steemit, old person dey here? Na youth dey hustle to write, to see say we fit make money hold body. Our generation dey do wetin those old papa and mama wey dey government offices no fit do.

Na so our President go London go talk for interview say Nigerian youths dey lazy, say we no go school, we dey claim say Nigeria na oil country so we dey sit down dey do nothing dey expect free house, healthcare and education.

Abeg Nigeria youths and the old generation who lazy pass? those old generation wey no wan leave office. they enter office when them dey young, how many companies dey open and how many people dey give job? Even as they don old, dey no wan commot make vibrant youth do something, they wan dey chop money up and down. The only thing wey dem sabi do na to steal our money year after year.

But Nigerian youth dey always find way to do one business or another, even if they get job, they go still find way to do something, employ person put. Some people wey dey steemit dey work outside, most of them dey school.. Abeg how we come dey uneducated and lazy?

The thing wey tire me pass, be say na for another country (UK) wey e go talk that kind thing.
Abeg make una help me reason this matter..
Wetin our President talk na true?
If you think say na true, wetin be your reason?

Na @nmalove carry this matter come today

DQmQkNYBpYh7mPEJV6KFqxCfneCsy8kYxgzH7Lg91z6zf7o.jpg
Na @mittymartz design this ogbonge avatar

Sort:  

Hmnnn...e well for Naija.
Na pray make we dey pray, and as we dey do am, make we go get our pvc make we for take vote the right candidate next year. Buhari don tire us, chai, maka-wai?

Yes na true unto say he dey refer to him people for Katsina. Na him no wan do anything and they dey comot for their land dey go cause trouble give people wey dey husle their own jejely. Buhari dey refer to him fulani people wey no sabi farm but dem wan feed their cow.

Make una ready 2019 make we carry dis Buhari back to Daura, he don too spoil our name for international community.

Nigeria lazy but the most educated family for UK wey him dey na Nigerians, we get over 5 Nigeria for UK parliament and he say we lazy.
The most educated migrant for USA na Nigerians, Heavyweight boxing champion Anthony Joshua na Nigerians.

Make i stop here before I vex carry Buhari picture dey begin dey slap am

Lol, slap dey allowed.. The man just go fall our hands for yankee..

Buhari is a Buyeke, wetin he get for head wey he think say in dey yarn better. The bros don dey find excuse wey in go give Nigerians for 2019 say in dey work, but na we youth no dey do anything. May we leave the senseless boy alone

nawaaa for this our junky Mr president we get oo. Nigeria youths na them be the most vibrant youths we get for this ogbonga world oo. God dey oo. @naijapidgin good info. i just followed you now.

Bros I cut for you as you bring dis Mata come enter this our site. You see.... Wetin Buhari talk nor surprise me bicuz wen person don old e dey talk like small pikin,so na old age dey worry de man brain.bros Ehen, If we lazy we for not come de hustle for steemit sef.

I just dey speechless because bros Buhari fall my hand big time.

Something dey wori dat man for head... No be normal. Make him just kukuma go mountain of fire make them cast that demon for him body Comot. Nonsense and laziness. Him wey dey very hardworking Wetin him don dey do for Dis country since? All they beta beta news we don't dey hear for our country Shebi na old people Like him dey make am happen Abi him wan make we list am For him again?... Sha na him village people for his side dey lazy so make i say na ignorance dey wori am.

Say baba
Say buhari
😂😅

Coin Marketplace

STEEM 0.30
TRX 0.12
JST 0.034
BTC 63877.55
ETH 3143.56
USDT 1.00
SBD 3.97