BLACK PANTHER MOVIE

in #naijapidgin6 years ago

image.png
Source

My good people, una good day oo.



I no know if una don hear about the weli weli noise of Black Panther. Na so so the film dey make plenty noise for my dormot. Infact, na the weekend wey pass na hin my friend and I for go watch the film for cinema house but we no fit go because time don go.



Shey una hear say five Nigerian acts dey for the movie; I no say that one no be news again.



Shey una hear say the culture of the Southern and Western part of Nigeria dey for display inside the movie. Infact, they wear agbada for the movie sef.



The koko of the matter be say in case you no know before, that film wey dem call black panther don dey break many many record ooo for box office.



Na beg I dey beg oo if you don watch black panther how you take see am ?….shey the movie worth the talk ni abi na only noise them dey put for hin head.



Yawn me make I hear abeg. Naso e go be for now.



20% of this post payout go go to the person wey him comment get enough people dey follow am argue inside and the one wey get plenty upvote.

Na @turpsy format and edit this pantherlized post wey @aprecious write for our ogbonge @naijapidgin.
If you go like join us for Telegram, click here

image.png

Sort:  

I don watch am.. The movie go well, i dey wait make e come out for CD, make i buy watch am again..

that one good o.

I hail una weh be d bone behind naijapidgin o.
Me neva see d movie sha bt i don read the preview,na badass movie e be....na just work mk me no gt time go see d movie....

Bros u dy miss oh.. The movie make excess Brain...wakanda na D name of the African country wey dm use, but as I hear d name so, I cm dy reason Weda I dy Africa again cz I never hear that name for any Country since them born me oh

U suppose know say na movie e b,so dem fit fictionalize any name or place...so most likely, Wakanda na fictionalized name....d money weh d movie don gross 4 box office sef dey gimme serious orgasm aswear.....

As u Don yan am so, I go try go see am maybe dis weekend Sha.... Na d whole of d black man continent dey commend d movie....

Try see am, so that you go fit get first hand information for us

Na so na, i go go see d movie on sunday so, make baba God let me ..

Me sef neva see d movie but I hear say d movie too go well sha...

Based on review weh me read on wikipedia n d amount of bar d movie don gross worldwide, na bad ass movie...

Me just dey wait till I go see am download cos work no go allow me watch am for cinema...na only Sunday I get 4 myself and I go prefer to run tns at home ....

I like ur own style sha, u no just wan give urself any stress unto any movie....say peson dey run go cinema sef na just mk e no b like say na peson dey bak pass....i feel ur style joor....

Awesome movie for sure!
Please follow, upvote and comment on my post also, thanks
Thumb02.jpg

Me self don watch black panther and I can say the movie no be only mouth ooo the movie make die. But you dey talk about the movie like say you don watch an

Heeee. Me self suppo go yesterday

I never watch am sha but I dey plan to go video am for cinema so I go come share with my steemit brothers them😀

hahahahah. If dem catch u pere

Guys no dey smile ooo at all at all....Abi now, make una give us work to get money wey we go take go watch black panther.
Screenshot_20180304-181920[1].png

My naija people no dey carry last. Na so we wake up one day we hear say Funke Akindele go dey for black panther. Before we go sleep com wake up again, we don hear say Funke no dey there again ooo say na Genevive de there. Finally na so we here say na hack our people they hack their cast list.
End of tori Funke Akindele no dey, Genevive no dey.

Hahahah. Abi o. Funke Akindele no fit do wetin dem do for that film with clear eyes o

Na be say the film pass her level be that

The movie make sense Sha. But me no like the fact sey dem show Nigerian with Ghananian accent. Which kind thing be dat one.

Also, why den go dey project Africa as people wet still dey dress half naked Dey dance about. We don pass that level...

For me, the movie na over hyped movie. Na marketing make am blow like dis jare.

Abeg who agree with me?

Yes ooo my brother

You don yarn your own, make we see who go agree or counter wetin u talk

i neva watch am ooo but some of my padis don go watch am for cinema and infact d gist wey dem give me self i sabi sey d film go make mad sense as in no be just sey ppl just dey loud dis movie but d flm make sense die d trailer lasan gan na die as in me self "mo fo" for am una kn ow sey for here me dey always talk my mind and i be correct movie critic iffa don watch am den i go fit tell una as d film take be but for now ooooo it make sense

u try o. u go need enter cinema very soon be dat.

I neva watch the movie o.....
but the movie plenty noise the enter my ear.
wetin shock me pass Na dis one
Naija no dey carry last
DQmWVnpX1Zx5L8i37w3Rd3Gxgi8YwmNZt7PjX9bsvXV1cLY.jpg

chaiiiii naijaaaa dem no even allow d original film touch ground dem don do their own abeg make person tell me why we no dey fear God for dis country ehn our nollywood ppl we gat talk to dem oooo make dem no dey do all this kind things for us dis tin jus dey funny me

hahahahahaha.... naija na my country.... we dey recent

Lol. OMG. Naija no dey carry last

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.12
JST 0.029
BTC 61533.72
ETH 3447.25
USDT 1.00
SBD 2.51