My blind date encounter with engel

in #naijapidgin6 years ago

I carry my greetings gbam,throw give @naijapigin,wey carry this one come. I know say una no dey carry last for matter. This is my first time into contest. Twuale to the organisers
@zizymena n odas.

images-3.jpg

Here i carry my tori land gidigbam. This tori na experince wey happen some years ago for real life. That time we 2go na the happening social network.
As i enter the general chat room,for there we dey counter attack each other like say we dey war.
One evening as i enter the 2go as usually,come begin dey find wahala.one name like that come face me personally like say na cause wetin dey do am.wetin man pikin get do na to just follow back the attack.

The attack come heavy on the person wey fire me.na him dey person come follow chat for private dey beg say make i no harsh again say make we join hand attack others.

I accepted the contact,na there i come know say na girl i follow dey blah but problem dey as i no get mind follow girl yawn.

Like that we come become friends,exchange our phone numbers state our status. Anytime we we dey talk on phone, as the girl dey sound with her sweet and innocent voice i dey feel say e get wetin she dey want me talk but my end i no know wether na not man enof be my problem.

A day come wey i no know the kind spirit wey enter me that day, i begin dey ryhme for girl,the thing come dey enter like wetin i dey see for america film. We come book appointment to see each other.

Na here the tori change leg. All those sweet melody wey dey fill my mind if i call her on phone, na here e get k-leg.

My friend called timaya,escorted me to port harcourt to go see the invisiable damsel. Come see as i carry my last card wey my parents pay me for weekend up keeps,see well ironed satch shirt.i come dey feel like na me be jonathan.

As we reach Ph,i come call her her line for her location. She directed to an eatry. As i get to the location i come see one sexy,slim,Agbani,thinking say na she. I come give a sexy smile as she dey approach my direction but to my surprise e come person wey dey my front she follow dey smile. I dey small,come carry phone call am,she come ask me wetin i dey wear,i tell her na so she sharp sharp talk talk her dress color n hair pattern she dey carry.

As i sight her from the door of the eatry,my brother disappointment full my body. As i wan take off na him my friend advise me say we go risk am all the way from Aba to Ph.

I pretended as we follow her enter the eatry. My problem come be the way she dey jump round my body like say she don jam davido.we chatted,drink and even take pictures but inside my spirit i know come entertain that movement again.

After every,as i dey motor dey go back na so she dey call till i reach my destination. That journey come make me to advice myself against anything BLIND DATING.

Na so my tori be........

Image gotten from: wikihow.com

Sort:  

Well done bro,it was well tailored in pigin.
Hope you were not the victim in the story?

My dear is a real story ooo

Well that the ugly side of social media, I believe next time you won't even think of meeting with someone you met on social media. Once bitten, twice shy.

Congratulations @lapb! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of upvotes received

Click on any badge to view your own Board of Honor on SteemitBoard.

To support your work, I also upvoted your post!
For more information about SteemitBoard, click here

If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

Upvote this notification to help all Steemit users. Learn why here!

Wow this is beautiful. I love your writing skills, we try writing on pidgin soon

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 62702.02
ETH 2572.25
USDT 1.00
SBD 2.75