BLIND DATE EXPERIENCE

in #naijapidgin6 years ago

05547BB8-527E-46C8-A21E-20A7CED81CAB.jpeg
Image credit
Happy Sunday better people.

Those days when I be pikin, if I see babe wey I like dey pass front of my house, I go run enter house Con open the door small dey peep.
Nobi say I don change as I grow but the style wey I dey use don advance.

As I dey shy to ask any babe out, I no get babe and na im make my friends dey concerned.
Where I collect award na on top social media, I fit toast any girl there but for reality I be coward.

This ogbonge thursday, my friend tell me say him get babe wey him wan make we reason together so he give me the babe number and him talk sey he don follow the chick reason so na to just fix how me and her go take see..

As I save the babe number, na him I sharply go check her pics ontop whatsapp...
She fine o..
So I sharply call am and she reply me well so I fix date for Saturday and she agree to come.

From that Thursday till Saturday morning, all the dream wey I dream, na the babe pics I just dey see....I just dey pray make time for the date reach..

I baf con wear my favorite cloth Waka go the venue of the date, I call the babe and she tell me say she don dey road.
As I dey the place dey observe, na him person wey resemble the babe drive come pack her ride (Mercedes Benz Eseries) con Waka enter commot phone call..

Na him my phone ring she ask where I dey and I tell am.. To my surprise the babe wey I think say no be she Waka come meet me..
I just dey shake, as I Waka to go welcome am, I miss step fall yakata for ground..
Na the babe come help me up as we Waka go the sit together..

She too fine and she con get money plus say I never stand face to face follow babe talk, I just dey sweat before I talk one thing I go stammer...

I believe say the girl understand everything wey I dey go tru...because as I order something for us and we start to dey talk she just open up to me say she like my person and she know say I dey shy make I dey open...

You belive say before the date finish we don dey laugh together, I Con dey free dey talk because she no form at all..
Na my best blind date experience be that o.

If you never join naijapidgin WhatsApp group, oya click here

Coin Marketplace

STEEM 0.31
TRX 0.12
JST 0.033
BTC 64341.19
ETH 3145.13
USDT 1.00
SBD 4.00