NAIJAPIDGIN VARIETY SHOW; PART2!! OYA! LET'S GO THERE!

MY PEOPLE! MY PEOPLE!!

I Don land again oooo
How Una dey? Happy Sunday!

image

As usual I waka with my Oga at the top, my show husband @imbigdee to come announce the part two of naijapidgin variety show today by 6pm at the usual usual... our naijapidgin discord channel

Mehn! Last week sweet die! Infact I no dey talk much today, if you know you know...
You know as Ih dey be na... Oya let's go there!

Today show go take another shape ooo
Talent and quiz go join together so that make people no sleep for road...😂😂😂
Last week people carry new new talent con dey intimidate people, so tey some fear run commot after them hear talent😂😂😂 today Ih be like say person go build house seff for the show 😂😂😂

  • Abi na singing talent Una wan show us?

  • Abi na pidgin English poem recitation like @warpedpoetic

  • Abi na romantic emotional totorike poem like @onoz

  • Abi na voting power you get to vote winners like @zoneboy

  • Abi na the usual bad belle talent like the untalented...

We dey welcome all of these performances.
No even yarn say you dey fear quiz...

Afterall @afolwalex use tumbumtumbum take win 🚶🚶🚶🏃🏃🏃🏃

Abi na spelling error talent you get like some participants... 😯😯😯😯 make I shut up oooo before them block me for road. 😂😂😂

Abeg come one come two... we need Una...
Above all fun full ground remain! Laugh laugh, cry cry, joke joke, mumuism, badbelleism... all in one.
No forget say our Mamas dey gidigba @ogoowinner and @zizymena as our overall!

No forget another hotseat go dey after the show. You know as the last one been dey with our boss @tojukaka.

Below na proof of payment to the last winners... this time many double go dey
image

This other one na those, wey resteem get am
image

Oya if you know yourself rush upvote, comment and resteem sharp sharp to claim your package.


**Our senior men and women for naija Steemit, Afar na? We dey wait for Una sponsorship ooo. Abi Una dey find courtesy visit?** 😢😢😉😉 Abeg no open that kind leg oooo. Meet our Mamas for @naijapidgin drop something sharp sharp. Or you meet me **PRIVATELY** at the other room. 😂😂😂

I remain Una special gallant okrikpata okrikpoto WarriCalabar girl Itoro Archibong. 😘😘😘😍😍😍

WE DIE HERE!

image

Sort:  

Congratulations! This post has been upvoted from the communal account, @minnowsupport, by itoroarchibong from the Minnow Support Project. It's a witness project run by aggroed, ausbitbank, teamsteem, theprophet0, someguy123, neoxian, followbtcnews, and netuoso. The goal is to help Steemit grow by supporting Minnows. Please find us at the Peace, Abundance, and Liberty Network (PALnet) Discord Channel. It's a completely public and open space to all members of the Steemit community who voluntarily choose to be there.

If you would like to delegate to the Minnow Support Project you can do so by clicking on the following links: 50SP, 100SP, 250SP, 500SP, 1000SP, 5000SP.
Be sure to leave at least 50SP undelegated on your account.

My boss them afar na... This Una comment, then no dey hide am😂😂😂😜😜😜😘

Na that same tumbumtumbum I go use win today own self.

Nor go try yourself oo

Hahahhahahaha. Oya come and try your luck na😜😂

@Itoroarchibong, thank you for using the naijapidgin tag.

We encourage and support minnows.

Join us on discord: https://discord.gg/5SR8CH4 for more fun and to submit your posts for curation.

You like what we are doing and would like to support us? Join our trail here: https://steemauto.com/dash.php?i=15&id=1&user=naijapidgin


Sponsored by @ogoowinner

Upvoted and Resteemed. I go try dey today to. Sing like Celine Dion.

Notin do una o, we go dey on top the show gidigba, u hear me so?

I'm ready. Just did the requisite requirements. Sorry, I don resteem con upvote join. I don do every every.

You no go for church o, make u dey dance shaku shaku for middle of the center o.

Great show this far...
Today own go get sauce... Lets go there!!
See you on discord

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

The mandate is mine tonight....
I be moving train. No try crossing cuz i fii cruse

Coin Marketplace

STEEM 0.33
TRX 0.11
JST 0.034
BTC 66438.74
ETH 3268.32
USDT 1.00
SBD 4.39