But Why E B Say Na Poor People dey born pass Rich People?
I greet all my fellow steemians o especially us we wey come from naija. This na my first time wey I dey write post for our pidgin o but the topic sef ehhhhh reach to use pidgin for o.
This my topic na as a result of things wey I don think think, I don tire. If I dey waka for road mostimes and especially market place, na so i go dey see women wey get belle but still dey lead about 2 to 3 pikin them for hand. Some sef go even still carry one for back. Anytime wey I see that thing, I dey vex well well o. Naim make me say make I ask some people about wetin Dem sef think about the whole matter.
Source
For our country naija so, u fit see one man wey poverty don finish him life with 5 to 8 pikin them for inside one chikili small room with him wife. He nor go fit take care of all of them o yet he go still dey born born and the thing dey worry my mind tire o. WHICH CAN LIFE BE THIS SEF? Anytime wey I see this kind thing ehhhhh, my body go just begin pepper me because na the woman I dey sorry for because na she dey suffer am.
As the thing do me so, Naim make me begin ask some people o so that I fit get their own side of the matter too. "WHY E BE SAY NA POOR PEOPLE DEY LIKE BORN PLENTY PIKIN PASS PEOPLE WEY GET MONEY?"
Source
Make ona see wetin 1st Person yarn o!
He talk say "na because say the people Dem wey poor get enough chance; so they nor dey busy as they nor get work. The person still say the people Dem wey get money nor get that time sake of say Dem dey very busy with their work so that one nor go give them time to use dey born children up and down."
Hmmmm: this one strong o
The 2nd Person own o;
The yarn be say "she herself dey worried about the same matter Naim she too con ask one woman wey the thing happen to. She talk say wetin the woman tell am ehhhhh reach to make person cry sef. The woman say na the husband nor dey allow am rest, say she don 3 pikin for inside 3 years and she still get belle as Dem dey talk so o. Naim be say na the fourth pikin she go soon born so o.
Na wah o
The 3rd person mouth;
Him talk say "because say the poor people Dem nor go school. Say the poor people dey always think say since the rich them get money pass them wey poor, Dem too go pass the rich people for number of pikin. Only say them don forget say those times don pass wey Dem dey count children as money.
She still yarn say the too much pikin wey this poor people dey born Naim contribute to like 30% of country palaba. Many of this pikin Dem now especially the ones Dem wey be girls don turn housegirls and messengers for inside those rich people house. The ones dem wey be boys now fit enter arm robbery, turn kidnappers, dem go still enter cult.
Na only papa God fit save us o!
Source
Abegi Make I ask Ona this Question o
Say person no get work do naim go be the reason why Dem go dey born anyhow? Even some of the people wey get plenty money still dey less busy but Dem still dey control their self.
Oyibo say;
An idle mind is the devil's workshop
Say you get 6 pikin for inside 6 years na accomplishment be that one?
I thank all of ona wey read my post o.
@Eddie23, thank you for using the naijapidgin tag.
We encourage and support minnows.
Join us on discord: https://discord.gg/5SR8CH4 for more fun and to submit your posts for curation.
You like what we are doing and would like to support us? Join our trail here: https://steemauto.com/dash.php?i=15&id=1&user=naijapidgin
Thanks for using the girlsfoundation tag as one of your tags. Don't forget to follow @girlsfoundation.
you can also support the girlsfoundation by following our curation trail using steemauto
Na consolation, my people dey say pikin na wealth. If parents no get money dem get hope say one of them pikin go make am.
This comment was made from https://ulogs.org
Lol... Na so e really be??
Congratulations @eddie23! You have completed the following achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :
Award for the number of comments received
Click on the badge to view your Board of Honor.
If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word
STOP
Congratulations, this post has been upvoted using the Steemjet community account. Keep publishing quality posts using the steemjet tag to earn curation rewards.
Join us
Community blog - @steemjet
Steemjet Discord channel-https://discord.gg/vdZe8JW
We hope to see you around. Keep Steeming!!!
Ok