The Creed Of Life. NPC; Episode 3

in #life6 years ago (edited)

My people, una wehdon o.. I don come again this week.
Mek I first throway salute give my madam @ogoowinner she don too try Abeg. E no easy to dey get this kind beta ideas on how we fit take beta our immediate environment.

download (2).jpeg

source


me believe say all man get right mek pesin see am folo hear him tori. I believe say everybody get right mek another person love am.
me believe say everybody e no dey equal, e no mata weda you be black or white pesin.
me believe say the world big reach to contain everybody and e no fit ever full.
me believe say all man na master for one thing for him life.
me believe say everybody dey special and unique.
me believe say everybody get good side and bad side. I go do all wer I fit mek anybody bad side no show instead mek him good side show.
Me believe say all race, religion and social status be nothing but the creation of contentious men wey dey come dey control others, come dey cause strife and in-plant the supremacy mentality. So me don choose say i go be "human first" before i go be member of any race, religion or class.
Me I go mek sure I only do pesin wetin I go like mek him do me.
Me I go make sure say I no copy anybody for this life, I must be myself.
Me I must make sure say I no laugh pesin for wer hin dey now cos I no know tomorrow.
Me I must make sure say I no look down on pesin.
Me no go allow envy, jealousy and greed control me.
Me go try make sure say I don drop positive impact for this world wer be say if I die them go remember me teh for wetin I do.
Me no go ever allow make fear intimidate me for this life.
Me no go ever free myself for were negative thoughts dey, i go always over power am with righteous thoughts wey go impact for people life.
Me I believe say life na journey no be race so I no dey compete with anybody for anything.
Me I believe in peace.

Me I follow believe in charity.

I follow believe in forgiveness join.

I believe in love sure sure.

I believe in mercy ghen.

I believe say justice for all na d best thing.

I dey always believe in human race.

I don decide say I go "live" no be to just "exist" for this world.

I @ungest go make sure say I do as I ran for this creed all the days of my life.

Muse : 2 Face Idibia

@ungest

Sort:  

As you talk am na so e be o,, this life na turn by turn,,, as e be now we suppose dy salute evrybody wey we jam o , fashi say you hold bar now,, everybody na boss for him own pocket o...

Baba, you sef sabi this thing... Mek pesin no come carry money wer him get today put for head weda na Sbd sef..
Everyman get him own empire, you no know wer yu fit go jam pesin tomorrow.
God bless you wella as you tek time read this post!!

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.12
JST 0.027
BTC 64886.88
ETH 3516.64
USDT 1.00
SBD 2.37