Introducing myself

in #introducemyself6 years ago

NA ME BE THIS (INTRODUCING MYSELF)
Hello steemiants, Una well done o, Na me dem dey call Edegwo Festus Obaroakpo a.k.a fexy50. My papa tell me say I be from Delta state wey the slogan be “The big heart”. I get degree for Mathematics, I get anoda degree for Educational Administration, both Na from Delta State University Abraka. Dat one no do me, I come still get sabificate in Project management, sabificate in Human Resource management. Now I come still dey fight for the one wey oyibo dey call second degree, (M.Sc) Business Administration for Ahmadu Bello University Zaria (distance learning) y bcos I too like money, no be my fault, my pile (father) & mile (mother) Na business them dey do, that one come even make me get my own business.
C. E. O EFOTEG CONSTRUCTION NIG LTD.
I dey sale and supply building materials. And I dey manage building projects too.
Am married to my heart rob @odietetessy and I get one beautiful daughter wey go soon join steemit.
20180101_170857.jpg
20180106_181315.jpg
HOW I TAKE JOIN STEEMIT
Na my first post be this for steemit, but I been Don dey hear of am for my house bcos my younger brother @prechi, the last born of the house @ahmprisca, my elder sister @dinah4sure and my wify @odietetessy dey sing steemit like the chorus of west life coast to coast. Make I for no carry last base on delta pikin wey I be na me self carry my two left leg go the Steemit reach out seminar wey @prechi organise. After the seminar Na em I tell my self say I no go fit dey inside river make soap dey enter my eye. I sign up sharperly so that me self go still follow them explore and reach out to many oda people just the way @tojukaka, @ewuoso and @prechi dey do and at the end the aim Na to give back to the community.

IMG_20160623_085910.jpg
MAKE I DESCRIBE MY SELF SMALL
I no too tall, I no too short, oyibo call am average, I fair small and I be fine boy (ask my wife @odietetessy) I dey cool, calm and collected. I dey like play football, table tennis and I dey like make good friends, I love good musics, I dey travel well well, I speak Hausa fluently, Yoruba small, igbo small, and I dey like give and help people wey no too get oyibo call dem less privileged. I like politics die, I been Don serve for different capacity wen I been dey university, the last one Na Director of information (S. U. G) Delsu. I get intention for the Red chambers someday.
IMG_20150610_111524_edit.jpg
IN CONCLUSION
Steemit Na the best place to be, I hope all steemians go accept me the way I be, I believe I go catch fun here, make plenty good friends, and learn new things. one love to everyone here. Thank you, Merci, asante Sana,obrigado.
Cc:
@prechi,@dinah4sure,@ahmprisca,@odietetessy.

Sort:  

Welcome to steemit

Thanks so much, it's a privilege been here

Congratulations @fexy50, you have decided to take the next big step with your first post! The Steem Network Team wishes you a great time among this awesome community.


Thumbs up for Steem Network´s strategy

The proven road to boost your personal success in this amazing Steem Network

Do you already know that awesome content will get great profits by following these simple steps, that have been worked out by experts?

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.12
JST 0.028
BTC 65566.66
ETH 3559.87
USDT 1.00
SBD 2.48