When My Time Go Come?
Baba God,no be say na disturb I disturb you ,
Na question I want ask You
Cos e don tey wen I de wait
So tey e be like say my faith want fade.
Abeg, when my time go come?
I don go wedding tire,
But I never marry
I attend occasion tire
But I never make merryment
Baba have mercy
If my question don de lack weight
Patient dog,dem say de eat fattest bone
But I never eat mine since I born
Baba ansa on time,
And tell me when my time go come?
E don tey when I waka from getto to kpako,
De tummble hustle for jungle
While my paddy dem de jolly for Yankey
Baba God na beg I de beg,
When my time go come?
My employment na always come tomorrow
Sotey my faith sef don de narrow...
Dem say tomorrow go beta
But e be like say for dis mata,
Wata don de pass garri.
Baba wen my time go come?
Time to fly higher;
Blow like Timaya,
Break record like Obama
And win like Rima?
Baba when my time go come?
When my cash out go blow me
Top the table every season
I no be one season lady.
I don tire to hear grace when you ask people how you take make am for life
Baba God show me the way forward
It is what it is @steem-ghana.
What God can't do does not exist, na people slogan
When my time go come that every post I go dey make dem dey upvote?
Posting na moi-moi but na the upvote.
Wow
This is great
I think I like this post
Its the pigin for me
I don't think but since you like it, you can have it
My sister, I de tell you. Posting na moi moi but na the upvote be de Koko. We still de wait. Nice poem . U killed it bae. Weldone
Thank you very much and I pray we will wait and lose weight before that time go come.