WETIN YOU GO DO, IF YOU WIN 20 MILLION NAIRA?

in #esteem6 years ago


source

My countri pipo!!
Una wehdone oo.. Like play like play August don finish, I dey wish una happy new month in advance.. TGIF!! Make una dey jolly..

Omo I just wake up this morning dey reason money matta, I just dey imagine say i win jack pot of 20 million naira, chai! Na happiness over load go full my belle, I just dey reason the kind life i go dey live, e come be like say make everything just dey happen now now..

I come dey ask myself wetin I go do if i get that kind money now. I go commot 10% first, carry am help less privileged.. I go commot 1 million take settle small small wahala, if change remain i go carry the change enjoy myself small.. Then the remaining money wey go be like 17 million, I go carry am do the business wey dey my mind. Within 2 years, I go don blow so tey space no go dey, lol..

I don talk my own o.. O ya make una begin talk.. If you win 20 million naira wetin you go carry the money do? Which kind business you go do? Make una chook mouth for this matter..

Na @nmalove carry this matter come una domot..

Footnote

**If you would like to support us,

Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows.

Before I forget make I announce d winner of our yesterday cook your way to 2 steem contest

Make we join hand congratulate @itoroachibong wae win our contest
2 steem go fall on you

Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

[Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Steemit Diary + Amebo with @rebeccafl [Fridays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapodgin Team:

The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...

@ogoowinner

@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde

IMG_20180319_092844_398.jpg

Avatar designed by @⁨@mittymatz

Sort:  

O boy ehn, if I jam that kind money I go use 14 Mila invest for my farm bussiness, I been dey reason a sustainable organic farm so tey, but no money to achieve am. I wan have a farm wey people can buy farm fresh product at affordable rates.
Then I go use the 4M invest for crypto(Steem) take the remainder jolly my life.

Mehn if I get that kind money na agriculture I go put am oooo...do poultry,piggery and all that kind biz for the money to increase I go never borrow for my life be that

Firstly I wan salute Una as Una see my good cooking skills bless me with 2steem. Una too much.

20million? Hmmm
If I get that kind money ehn, na to build house for me and my family first oooo and to open wholesale shop for selling of bags for UYO. Because That kind thing no dey here.

Hmm, If e happen say I win 20Mill, I go first buy land, build a descent house, even buy small motor join. then any thing wey remain go enter my crypto investments. All this one na after I don arrange my malee better package .

Did I hear 20million?, guy with 20million I Don blow o.. See that my dream way I don dey pursue, with 5m, I don set everything on ground, business don start. Then the remaining, I go buy enough assets with am.

I go use am power up simple like ABC make people suck my balls for upvotes 😉

Posted using Partiko Android

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 63237.60
ETH 2647.23
USDT 1.00
SBD 2.81