SARS wahala

in #esteem6 years ago

image

Source

Una good morning my country pipo how una dey this cold morning I believe say all dey go well with us we for naijapidgin dey wish una a happy new month o.

Our prayer be say this new month go favour us and God go bless us and e go beta pass last month despite the bad bad things wey dey happen for we country, make we jus continue to dey pray sha.

We don bring anoda tori wey dey trouble Nigerians jam una today first Wednesday of the month of August na SARS(Special anti robbery squad) na im we know dem to be we go don hear all the bad things wey dem dey do innocent citizens,how they don kill pipo for things wey dem no know hand and leg for.

One Nigeria rapper wey him name be illbliss don come out talk him own experience just like others say him and his manager just dey drive o na im SARS stop dem for night tell them to lie down for ordinary ground say them dem dey search for tramadol and other drugs just imagine na so this SARS dey assault many artist and pipo everywhere,na criminals government the them to dey catch but na innocent citizens dem dey harrass up and down him don call on government too to do something about their mata very fast.

Abeg my pipo wetin una feel say government fit do about this mata we want make una talk una mind.

If you like what the community is doing and would like to support us,

Please follow our trail via
Or delegate SP to @naijapidgin.

We are naijapidgin community with a mission to 'Promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows

Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On @naijapidgin discord channel, a lot of variety shows and lectures are ON

  • Every Tuesdays we have real life issues with @preciousimo
  • Every Wednesdays are unavoidable lectures
  • Every Thursday we have relationship talk with @sparkles
  • Fridays is our well known ameebo center by @rebeccafl
  • Sundays is always variety night show by @itoroarchibong and @imbigdee.
  • Same Sunday we have our @naijapidgin hotseat ( featuring some well known steemians)

You ought no to miss any of our programs.

TEAM:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
@ogoowinner
@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde

IMG_20180319_092844_398.jpg
Avatar designed by @mittymartz

Sort:  

Chai! So Tramadol come be weed nii abi wetin? And me dey carry Tramadol waka around o. Those SARS no just know as e dey do them ojere. With Tramadol, every man is a champion.

Lol..you talk this one o

I just pray make everything Don go down before I serve finish o, because of SARS even if na toilet I de go I de carry my NYSC I.d card de Waka go o because for my side if you too dress you are on trouble, if you too fine you are in trouble, I weak I swear...

Confirm matter una dey run here.. i like am...

Nawa oo i just pray make me and them no jam one day oo

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 63061.76
ETH 2602.70
USDT 1.00
SBD 2.75