COOK YOUR WAY TO WIN 2 STEEM

in #esteem6 years ago (edited)

image

My country people, how una dey? I trowey ogbonge salute come una way o. Today na Thursday again and the last Thursday for the month of August. Hmm! This month be as e get o. From beginning till end na so so katataka for my area but I believe say una side bam wella. Anyway Sha, e don dey quarter to go and next wey una go see me on top this matter e go be September.

Una don ready for me today? Wetin I get to yarn una? E no get wetin I want yarn una instead na fun time na im I don carry come una side o. Wetin e be? Na very simple thing I want make we do this morning. I dey in a good spirit to dash person 2 steem but before I dash you the 2 steem, you go must do something for me.

Wetin you go do?

I no know how much be 2 steem now for we money but e go be around 500 naira. So if I give you 500 naira make you cook food for me, wetin you go use that money cook for me assuming say you get other ingredients for house.

  • List all wetin you go buy and how much each one be.

  • Tell me how you go take make am

  • The one wey belleful me pass na im go chop my 2 steem.

  • If I see another one wey my long throat go e fit still win something.

*You must upvote d post

Oya o where una dey we brothers, make you come see babe we be wife material. We sisters nko, make you come see man wey no Sabi manage o.

Na @zizymena carry this one nak una today. Wetin you dey look am dey wait for? Abeg begin yarn jor.


Footnote

**If you would like to support us,

Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to *promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows*


Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

[Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Steemit Diary + Amebo with @rebeccafl [Fridays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapodgin Team:

The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...

@ogoowinner

@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde

IMG_20180319_092844_398.jpg

Avatar designed by @mittymartz

Sort:  

Make I teach you as bachelor like me dey take chop for my own little way. 2 Steem na 500 naira for now.

1 Derica of rice = 240
Aboki tomato+pepper = 150
1 big size onion = 20
Egg = 50
Cold water (4) = 40.

As you carry am reach house, just pray NEPA light dey to take use blender. If not, na to use grinding stone. Put groundnut oil for fire till e hot, slice onions and put. After e don tey small, pour the grinded pepper inside the hot oil. Add Maggi, salt and if crayfish dey, put am. E go form the ogbonge stew.
Boil rice for fire parboil am if possible. Boil the egg and if e don done remove the shell and put am for the stew so the stew go fit enter am well.

Serve the rice come add the stew and the egg on top. Bachelor white rice and fried stew don dey be that. Make una enjoy am with cold water.

Hi @imbigdee you Sabi cook no be small o
Abeg this your food make sense. Husband material 70 yards na im you be

Hahahahhahaha no cold water person take dey cook food? why you no Carry ice block at once. 😂😂😂😂

You no go drink water if you chop finish? Take the joke back.

Oga find place sit-down jorr
like say na 40naira water you want drink on top small food

Loading...
Loading...

Me wey be say na ordinary kopa wey no get money, if no be say na by agino get money, if no be say na by agidi to serve my bya land, and you come give me 2steem patapata, wey be say na #500 na em be, I go give you ogbonge food wey fit do body good.

Na to go market wey dey near my house and buy sinkinni ingredient to go make confirm EBA with ogbonge combined okro soup.

Ingredients

  • garri 2 cups #80
  • okro na #50
  • pepper na #10 pound one (ata gungun)
  • fried fish na part sha #50
  • maggi #20
  • palm oil 1/8 bottle #60
  • salt ma neighbor get am
  • cray fish #50
  • Locust beans #20
  • pure water #20
  • animal skin (ponmo) #100 u go dice am and even add am join

I go use that #40 naira wey e remain do change incase you self come visit and wan drink zobo

NEPA light kuku kuku dey kampe in no need gass or kerosine to use am cook, I go even on fan untop your head as we dey chop am.

Hahahaha laugh want tear my belly @pearkreal1 but you no tell me how you go cook the food

Hahahah, to cook am na em easy pass.

Make I just carry water put for inside pot, make I put am for my electric cooker, when my water boil well well, I go put garri join am cover am small before I come stir am together with a stirring stick. My eba don ready be that, na to serve you wey remain.

To make my okra soup

I go cut the okra, put little water for put and carry am put for my electric cooker, I go allow my water boil small then I go add am my okra wey I don cut. I go put join all my ingredients Wey i mention and cover am small for chikini time. My soup don ready gidigba be that.

Na raw ingredients we wan chop? 😂😂 Abeg no kill me ooooo

Lol, you know na small thin nau, I don explain am

Loading...

Ehhhe....small thing.

Garri, cold water, fried fish with a little pepper, na heaven on earth be this on hot afternoons. You fit collect change sef.

This comment was made from https://ulogs.org

Babe u just had to do it the yoruba way

Well you are a wife material also mm when I marry you na 500 I go de give u...... #winks

Lol..funny person

This comment was made from https://ulogs.org

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! We encourage and support quality contents and projects from the West African region.
Do you have a suggestion, concern or want to appear as a guest author on WAfrica, join our discord server and discuss with a member of our curation team.
Don't forget to join us every Sunday by 20:30GMT for our Sunday WAFRO party on our discord channel. Thank you.

2steem is just too small to do anything kwa... I cannot do anything with it 😭😭😭

Make una increase am to 150steem then i would tell u how I leave my life in a small way... U feel me @zizymena

Huhuhu man that cannot manage. 😒😒😒

Haha, you just have to manage am o

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.13
JST 0.030
BTC 65236.35
ETH 3483.12
USDT 1.00
SBD 2.51