5 THINGS YOU NEED TO SUCCEED FOR STEEMIT

in #esteem6 years ago

We don come again my naija people. How una dey? How una dey hold body for this weather. Oyibo dey talk say na weather for two but abeg my people make una remember say na pregnancy for one. This na rainy season, wear cloth wey dey cover body and carry umbrella dey Waka.

Okay unto wetin we get for una today. Today own go dey different because we want talk about steemit. All of us for steemit dey here dey hustle how we go take dey earn small small money. Sometimes e go be like say we just dey pour water for basket. Sometimes e go be like say your village people no want make you succeed. Anyhow you take look am, steemit na business and every business get e own rules wey if you follow am you go grow well.

image
Pixabay
FIVE QUALITIES WEY YOU MUST POSSESS TO SUCCEED FOR STEEMIT

  1. You must like book well well. If you like call am bookworm. You must like to dey read book and to dey write. After all steemit na so so write we dey write so begin dey practice am now.

  2. Your internet go become your best friend. All the plenty plenty post wey you go dey post for your blog na internet e full. Na there you go see plenty plenty topics wey you go share for your followers to read. On top same matter you go like to dey chat for groups. Like naijapidgin now, dey attend all we show, dey comment for we blog like that and na so we go know you. Na so e still be for other communities.

  1. You go dey creative. Make your brain dey work wella. If you siddon anything wey dey happen make you dey reason why e dey happen and wetin you fit write about am. No use your brain dey soak so so garri. Make your brain dey sharp.

  2. You go get patience. No hurry for life. They say good thing dey come to people wey Sabi wait. No think say na magic or automatic thing. Dey do your thing, one day e go pay.

  3. Dey ready to do anything wey others dey do. No make siddon dey look be your middle name. If others say na steemjet na there money full, my people carry yourself go there. If you believe say you go make am, you go make am.

Hardwork na everything. Nobody wake up one morning hammer. We know steemit no easy but na jeje jeje we go dey go. Nothing fit spoil our shine. Your destiny na your hand e dey. Wetin you make out of am, depend on you.

Na @zizymena bring this one come. If you get other qualities wey you feel say fit help us grow for this steemit, you fit still share am for comment section.


Footnote

**If you would like to support us,
Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to *promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows*


Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

  • Real-Life Talk with @preciousimo
    [Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Steemit Diary + Amebo with @rebeccafl [Fridays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapodgin Team:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
@ogoowinner
@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde

IMG_20180319_092844_398.jpg
Avatar designed by @mittymartz

Sort:  

@Naijapidgin, una well for this okponge promotion of we Naija language. I stand gidigba with una till we come take over every every for Africa in the blockchain.

Yes o thank you jare say you Waka come put mouth for this gist.

We go dey do am jeje and I believe say with our support we go drive this motor go permanent site

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

Interesting and Lovely, but you no recognize me oh @zizymena...

RESTEEMED anyways.

Pidgin please

Lol and u dy use English abi.... E Suppose be "pidgin abeggi" no be "pidgin please"... Winks!

DE Don Com again.
Betta DE run like water for una mouth @naijaPidgin

Hahahahaha na so nah

Una don yarn beta matter...
This we steemit community nuh dey easy oh bet na small small person dey take find road.
I salute una

Nah so I believe say one day we all go reach there

Na true talk you yarn for here. Those mata wey u yarn above dey very important for success in this community. Una well done @zizymena

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.15
JST 0.030
BTC 65185.94
ETH 2630.94
USDT 1.00
SBD 2.83