4 Things Wey Una No Suppose Dey Do For Steemit

in #contest6 years ago

Some things dey wey no dey work at all for Steemit. Instead make dis things do you any good, dey just dey spoil matter for una here on Steemit. E no mean whether you don tey here abi you be new person on Steemit, some things dey wey you no suppose do again!

Make we see wetin I dey yarn...

(1.) Blind Following

One thing wey bad wey peoplke dey do on Steemit na blind following. Wetin you dey do when you follow person wey you no sabi wetin hin dey do, wetin hin blog bi like, na blind following. This thing wey dem dey call blind following no good so tey una blog go full with panti. The reason bi say una no check wella before una start to dey follow.

Sabi who una dey follow. Follow steemians wey dey kampe and make una dey yarn with them wella

Na so blind following dey work. No do am o!

(2.) Mass Following

Mass following bi say you dey follow people wey plenty. Dis one no be like blind following because na how people wey you follow plenty bi your concern no be wetin dem dey do or who dem bi. The truth bi say na the same mind wey you dey use do blind following na hin you dey use do mass following.

I don see person wey go follow thousands of profiles, e fit bi say hin get am for mind say hin go get person wey go follow am back. Person wey follow una through dis shortcut no go do una any good, dem go just park panti for una feed.

The kind follower wey dey kampe na the one wey fall for you or for wetin una write, wetin you share dey useful for am.

Una go useless where people over plenty. I dey yarn una, no do mass follow o.

(3.) Tori wey no get value

Shey una get followers wey wetin dem dey talk no dey do una blog any good, e fit bi wetin dem dey say for comments or wetin dem dey follow people yarn. Make una see dis kind mata.

  • Shey una like person wey talk wetin no concern wetin una put for ground?
  • Shey una like person wey talk like one or two words?
  • Shey una go happy if person copy paste comment wey hin link dey and hin dey beg you to follow back?

Make una put yourself in dat kind mata. Shey una think say e go good if una put comment wey no get meaning for other person post? The thing be say una no go like am for una post, so why una go con dey troway am for another person post. Ehn?

Steemit dey pay person wey dey add better thing to community. Why una go follow person wey no do Steemit or una any good?

PS: Make una see how I dey follow other Steemians relate for comment here.

This one na jagajaga person o.

(4.) Repel Steemians wey beta

Na dis one I go talk before I waka, the thing wey bad pass bi say una dey chase away beta steemians cos wetinuna dey post no good or you fit don dey do the things wey we talk for up. Wetin go make Steemit superstars dey follow you yarn? Why dem go upvote una?

Make una stop follow follow. Make una dey relate with people for Steemit wella, make una fit turn superstar too.

Make una no let beta person follow you talk this o.

Make I yarn this one before I park wella

I don talk wetin Steemit dey about for my blog. This post na to make Steemit better place for all of us wey dey here. I don do everything wey i talk for here and he work for me wella. I dey try make Steemit beta na why I dey yarn una all my experiences. 

Wetin i wan bring out from wetin i don talk

  • I dey try tell my followers wetin dem go do make dem no go shock themselves with jagajaga behavior.
  • I dey teach all the new Steemians make dem fit start well.
  • Make all behavior wey no good for the community turn something wey we go forget.
  • I dey try make i yarm am to plenty people (I no fit do dis without una resteem).

I hope say una gbadun my post. I thank all of una wey read am o and i dey grateful for una upvotes and resteems.

Sort:  

I gbadun ur post my brother yu b correct 9ja pikin.. I don learn plenty tinz frm yu.. Yu try wella bro

My oga I sight una. Na wetin steemit dey for be that o. Make we dey learn from ourselves.

Thanks for stopping by.

Yes o my nigga i dey feel you

Very happy to see your work. I upvoted it and resteemed as well. Hope you more rewards. You will get SBD reward from my payout anyway. Not sure how much but you are in for at least some.

I'm glad to participate. I was able to explore my writing skills in a Nigerian language. I do most of my writing in English and this contest made me write in pidgin.

Also, I was able to design the thumbnail I used with the help of your tutorial. I learnt something new. Thanks.

Best wishes!!!

#OWB

Coin Marketplace

STEEM 0.29
TRX 0.12
JST 0.032
BTC 62349.28
ETH 3026.88
USDT 1.00
SBD 3.67