Akwa Ibom Ayaya -Too Much! (Come to Akwa Ibom)

in #cityphotography7 years ago (edited)

5860698d4df00ecff6321f70e7124884.jpg

Hello steemians🙌🙌🙌

This is my entry for the #cityphotography by @juliank. I'm glad and will like to use this opportunity to write in our famous Nigerian pidgin English.

Today I wan use naijapidgin take write this post. So if you sabi am well Wehdone to you ooo. E mean say you be gon gon naija pikin. 💃💃


Anyways, I no go write long sha. I just wan show una this view of one state for Dis our fine country naija. That state na Akwa Ibom ooo and as e take fine, na so we call am 

"The Land of Promise".😍😍😍

If you no visit here before, I no no wetin you dey wait for ooo.. @gprince o dey were for you make you pack your bags come here ooo as you no go wan leave again. 

Even @arutynwa no wan leave again😂😂😂Life too sweet and peaceful for here. Na here I take come from sha. 

This na our confirm movie cinema ooo where all them fine boys and girls dey go sha just to snap fine pishure😂😂
IMG_20180220_102208_274.jpg
This one na our fine fine international stadium
IMG_20180220_102428_622.jpg
IMG_20180220_102339_377.jpg
This one below na our general hospital Screenshot_2018-02-20-10-20-25.png
This other one na our plaza where you fit see any thing we you want buy for this world buy😃😃
IMG_20180220_102150_707.jpg
This one na our fine amended road by our government pipo
IMG_20180220_102124_739.jpg

Anyways, make I stop here rush out as I get exams this morning ooo for school. Muna wish me luck Biko. 

E no easy to be university student for this our naija. That one be one topic weh i go like make we discuss. (Naija student and problems where we dey face for school). 

Una good morning ooooo 

Have a nice day. 

If you done visit here before make you just comment how your stay bin go If you follow be Akwa Ibom pikin make you follow Resteemed this post make this our steemit people see say Akwa Ibom make sense

Na your girl perky😍😍

Much love😘😘😘😘😘

Sort:  

Am coming ✈ 💃

✈....... 🏃 ✈

Coin Marketplace

STEEM 0.21
TRX 0.27
JST 0.040
BTC 102367.04
ETH 3705.53
USDT 1.00
SBD 3.23