The tinz wey steemit don do giv me (pidgin challenge by @ogoowinners)

in #npc7 years ago

IMG_7452-1-1.jpg
My smile has widened......

My steemit pipu, I dey troway salute o, Una wehdone. Na @annieben dey folo una yarn so. Anty @ogoowinners na beta hail I dey hail you unto sey you sidon reason this matter wella.

I neva too tey for hia but the plenti plenti tins wey steemit don do for me dey burst my brain, I dey tell you.

Hmm, my pipu. You see this one month wey just troway leg waka so? E don change me. I no been dey sabi read plenti tins o but steemit don do I dey read anytin; signboard o, book o, even newspaper wey the woman for my yard dey carry package sumtin sell gimme, I dey read am weda yarns go komot make I knack small post for here.

I no even wan yarn una unto time matter. Steemit don do wen I standa for morning I go dey write the tins wey i go do make I get time to drop sum kind tins as posts and comments.

If I no talk this one ehn, somtin dey wori my head. Steemit don do I dey follo people wey I for no sabi talk. Dem too plenti, I no go fit dey tell una all of dem name; for @stach wey dey do hub give us, @air-clinic wey dey comot smoke for my head with better better talk unto health matters; I hail una.

Tins brekete full ground but make I just drop this last tori comot. Steemit don do I no dey wait make my palé and malé drop small bar before I fit do som kind tinz. Na me even dey drop light change (for now) give dem make dem take coolé. If you bin see me for Christmas day ehn, as I dey do better big sis give my junior bros, dey buy anytin wey he wan chop give am....chaii e bin dey sweet me for belle.

Make I come dey go o. Now wey you don hear my tori, op sey you go follo yarn your own make I fit see.
Collect the link here
https://steemit.com/npc/@ogoowinner/naija-pidgin-challenge-make-una-tell-us-why-una-like-steemit

Sort:  

This is too hilarious... 😀 😀 😀

Lolz. Laugh small small

Dis your beta yarn sweet my belle sotey I just smile like sey I win lottery.
E go mek sense if to sey we fit get muscle to dey promote dis our pidgin wey dey sweet like sey tomorrow no dey.

E for make better brain o but na small small sha.

Lol... @annieben o... My goodness. I no fit speak pidgin o but this wan don bring out this part of me now now now.

Lol @mizdais na somtin dey make chicken run for night o. E good as e don comot

Annie ooooo 😂😂😂😂

haha I sure say my 2 by 4 Ghana pidgin no go fit compare but I go drop am laidat.

I see say steemit don dey change nibis plentey for ya syde. @annieben MA my belle don make empty sha, make una come fill am ooo. else I step Uyo p3 koti for com carry me go

I no bin sabi sey people for Ghana dey yarn pidgin o

It's fascinating to see somebody relate in a typical Nigerian way in this community... I wish I can be as fluent as you are...

I throway salute o...

Hahaha... It's easy o

Maybe you will need to lecture me... Lol

As in ehn... I can't participate.. I dunno how to write like this.. Lol.

Followed you... lol

Hahaha @pangoli @korexe come let me teach you

I'm waiting o!!!

Mama d mama😂😂😂
Abeg continue de enjoy your thing

How we go do na

Chai, this girl don finish me with laughter. Wehdone MA o. Plenty steem and steem dollars fall on you.

Lolz. Baba God abeg show am love for me o

dis your pidgin no be here ooo

Na your mouth I hear am o

...signboard o, book o, even newspaper wey the woman for my yard dey carry package sumtin sell gimme, I dey read am weda yarns go komot make I knack small post for here.

Lol... The things we go through to get inspired to make a post.

Wehdone! Lol

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.13
JST 0.030
BTC 65359.95
ETH 3492.90
USDT 1.00
SBD 2.51