Press hand give STEEM so that e fit get awof listing on NETCOINs, you self fit win love from Oracle-D

in #steem6 years ago

This post is an authorized pidgin translation for Oracle-d, The original article can be found here.

Na dey first time wey we dey comot hustle wey no be only our members fit do but all the ogbonge people fit follow put hand for the matter. This hustle dey easy wella and na steem go jolly am pass, That one na if all our country people put hand vote so that them NETCOINs fit carry am put for their list.

Even as steem the jolly pass, You self go see light joy from this hustle for plenty ways.

This waka dey open to anybody wey wan follow waka. If true true you love steem, then you no suppose miss this waka at all. Wetin sweet pass for this waka be say joy go comot when you follow for the waka.

Netcoins.png

WETIN WE WAN DO

Wetin you need do na to just press hand ontop steem so that netcoin fit follow carry am join for their list.

Has I dey yarn you now, them dey run contest wey go allow make we for press hand give any coin wey we for like make them carry join their list.

Try read “Task details “ so you go fit sabi how you wan take press hand. You fit press hand everyday until 6 days waka finish.

Note: You need sabi say dem don already carry steem put for of the coin wey dey wan, Now na to press hand give steem na him you go do. Kukuma read the “how you go do” for under make you for know more .

WETIN WE GAIN

Na two ways you go take collect joy for this ogbonge waka:

  • press hand give steem , you go come take picture ontop that screen wey go show say you been press hand true true. You go come carry this screenshot put for the comment of the original post wey dey here. You fit collect joy wey reach $1 but e go depend on how our voting power dey. Wetin sure pass na say the first 50 people wey post go collect joy wey pass $1.
  • Talk something wey make sense for your blogs/vlogs or for picture make you for collect joy wey reach $10. But you go get joy wey pass that one if plenty people come follow you talk for that your blog. No forget to add all the tags wey I go mention below as no show for you if one like this miss: #steem, #steemit, #exchange-blast, #promo-steem

Note:The first thing wey you need do na to resteem this post, because if you no do that one like this ehnn, e mean say joy no go reach you. We wan reach plenty people wey we fit reach.

As e be so, you fit do just one or you fit do the two but all na your hand e dey. No forget to read the "how you go do" make you for fit sabi how to press hand for NETCOINs contest page, that one na if you no fit sabi yourself.

HOW YOU GO DO

Do as I go talk below to press hand give steem:

  • Waka go http://contest.gonetcoins.com/
  • As u dey reach , waka go down until you reach the bottom, you go then find steem from the other coins wey dem follow carry for this contest. Carry your email id add for the text box then you come click “VOTE”

1.png

• Them go ask make you confirm say na your email be that true tue. Pres for the “SEND CONFIRMATION EMAIL”

2.png

• Dem go send you this email, click on am to confirm your vote

3.png

• As you click for the link wey dey your email, them go confirm your vote as e be for the picture below:

4.png

Wetin Be NETCOINs and Wetin e mean for us to be for their platform?

Na blockchain company wey dey ogbodo oyibe Canada and them don help plenty people wey pass thousand make them for fit buy and sell bitcoin. Them get Atm wey you no fit see and this ATM wey them no dey see don help give people wey dey sell and even professionals better ways to sell bitcoin for store.

Wetin e mean if Netcoin carry us put for their list:

  • E mean say we go fit the follow sell our coin for places wey reach 171,000 for inside 53 countries across 6 continents.
  • Plenty press release and media exposure for plenty sites and crpto sites (Nasdaq, Globenewswire, Coinmarketcap, coincodox etc…) go reach us yanfu yanfu.
  • We go come get Global OTC desk.

Source: http://contest.gonetcoins.com

AS E be so, Make we join hands make sure say them carry steem join body. Make them know say we self get strength together as a community because this listing fit make am rise too.

Note: Every Joy wey dey comot in form of sbd for this post the waka follow @ADOLLARADAY Zharitable Initiative by @pennsif.

Page Break Oracle D.png

Oracle-D

Na tear rubber steem blockchain business venture wey the carry plenty new investment come give our platform.

Na @starkerz and @anarcotech begin am, Na them also start #promo-steem and Steem-ambassador projects. Them been even comot campus curation system, wey be say from beginning to end when e reach time for joy, e been dey always be power to the people.

Core Mission

We no get any time for politics, as e be so, our number one wahala na to carry steem price make e for reach moon, Make plenty people come sabi blockchain and come dey make sure say people wey sabi create better content get excess joy. In short we just wan dey add value to the blockchain shikena.

How You Can Support Us.png

You fit put hand give us for this waka through the following ways:

  • You fit waka show us love through the campaign’s link wey dey above. This love wey you dey show us na to help us follow go events wey go fit allow us bring investors come this blockchain.
  • Na to follow upvote & resteem this blog and you fit help us yarn people about Oracle-d and all the better waka wey we dey waka.
  • Follow support pople wey dey help us write content so that better quality fit plenty for we blockchain.
  • Put hand for our witness ( @Oracle-D ) through https://steemit.com/~witnesses or you fit use Steemconnet do am.
  • Follow us as we dey show love to people. This one self go follow sama you better curation rewards.

We dey thank you for everything wey you don do for us, thank you as you follow us waka this waka.

Abeg no forget to reach us if you want make we join hands together so that this community fit grow.

Find Us At.png

Sort:  

I'll support you on this.Hit me up on whatsapp once you are awake so you can take me through the procedures

Ok dear. Thanks for the support

I go join you boss.weldone

Abeg come on board jare

Anything for steem to rise bro

It will rise

We here we dey, so we go support steem

We no get option self.. Steem need rise wella

Me dey follow press hand like this like this... Na press hand sure pass

God go bless us las las

If we no comot awa vote put for the matter, wetin we gain?

I swear.. We need carry steem go up by fire by force

Coin Marketplace

STEEM 0.33
TRX 0.11
JST 0.034
BTC 66598.01
ETH 3236.65
USDT 1.00
SBD 4.66