The Creed of Life. Sure things wey i go de do for my people. #NPC CHALLENGE

in #npc6 years ago

Prayer no de end for my mouth for this my big sis @ogoowinner wey de bring this edition of dis our Nigeria Pigin Contest, God go continue to de bless you.

Creed of my life

Creed make I first tell una wetin e mean, creed na person personal belief, my creed to de serve God 24/7, every Sunday make I de go church even if i no get beta cloth wear and to get one kind work for church, my creed go de different from your own creed because say my mind go de different from your own pata pata, e no de possible lai lai make we get the mind

My creed na to de help everybody wey need my help anytime anywhere, make i get free mind with every person, wetin i no fit do make person no do am for me at all

I no say for dis life ehn person just gats de very careful, make fight no de sup everytime

to get peace wit everybody wey i sabi and from bab God.

make i de help person de very important

make i de forgive person and forget everytime

make i de love person wit my full mind na hin sure pass

make i de get mercey for people wey de around me

Odunlade-Adekola-1.jpg

This person picture na my mentor Mr Odulade Adekola

God go bless una as una take time check my work

Coin Marketplace

STEEM 0.30
TRX 0.11
JST 0.033
BTC 64106.00
ETH 3129.71
USDT 1.00
SBD 4.16