"THIS IS NIGERIA"

in #naijapigin6 years ago

7559E0F6-115A-4C0B-8C2C-9108EA7E82B6.jpeg

"THIS IS NIGERIA"

Politicians dun dey FINISH US ....
They buy our vote ..usurp power ..
And start to DIMINISH US......

"THIS IS NIGERIA" ...
Mama Filo go dey MIMIC HORSE ....
Dey gallop from pillar to post just to get VISA ...
I guess she been dey GIMMICK US ...

"THIS IS NIGERIA" ....
The country is DYING ooh...
The government are LYING ..The masses are CRYING ..
I guess we are not TRYING ooh .....

"THIS IS NIGERIA " ..
Them say we dey RECESSION ooh ...
The problem dem no MENTION ..
.People living with TENSION ....
We dey wait for our REDEMPTION ooh .....
.
"THIS IS NIGERIA" ....
Economy is BAD ooh.....
Pikin wey dem born for here go dey question im mama say why she no born am for JAND ooh ....

"THIS IS NIGERIA" ....
Everything is SPIRITUAL ooh 🙏....
Your Muslim friend give u meat then u think im use am do RITUAL ooh 😒.......

"THIS IS NIGERIA " ....
The youths are LAZY ooh ... But we work upadan like slaves for cave ..... I guess PMB is CRAZY ooh ......

"THIS IS NIGERIA " ...
Police case na SITUATION ooh ...
Them go sanction for tyre .. Sanction for break light...
Till them take u go STATION ooh ....

"THIS IS NIGERIA " ...
The Sun🌞 is not SMILING ooh ..... You MAKE UP for morning ...
BREAK UP for evening ...
Then u know it is not your CALLING ooh ....

"THIS IS NIGERIA" ...
Light is not STABLE ooh ..
NEPA dey use Gen charge transformer ...
When I hear am I think say na FABLE ooh ....

"THIS IS NIGERIA" ...
Village pipo are RAVING ooh ...
Brother Uche for Italy dun turn dah imbecile nobody is CRAVING ooh ....

"THIS IS NIGERIA " ....
Judiciary system is BLEEPING ooh....
Hunku Metu reach court ..Feign Fall ...
I guess he was SLEEPING ooh .....

"THIS IS NIGERIA " ...
Under graduates are WEEPING ooh....
No money... No job ....
I guess I should be SWEEPING ooh...

"THIS IS NIGERIA"
Graduate kpali 📋 dey front of im MOTORCYCLE ooh ..
Im dey HUSTLE to BUSTLE so wan day im world no go crash like ULTIMATE CYCLE ooh .....

"THIS IS NIGERIA" ...
Education is CRASHING ooh ...
Lecturer go invite you come im office ..
All our galz dey be LASHING ooh ..

"THIS IS NIGERIA "..
We dey practice DEMOCRACY ooh..
But one hate speech and u enta prison ..
I guess that is DEMO CRAZY ooh ...

"THIS IS NIGERIA " ...
Falz na im bring this TREND in ooh .. Buh we dun paraphrase am.. Colonize am ..
And now it is TRENDING ooh 😂!

Coin Marketplace

STEEM 0.32
TRX 0.11
JST 0.034
BTC 66791.24
ETH 3239.69
USDT 1.00
SBD 4.22