how my friend take use my head

in #naijapidgin6 years ago

This stomach and mind deep gan, you no know wetin the person get in mind for you, e fit dey wish you well oe wetin he get for mind de evil.

backstabbing-friend-e1313497055636.jpg
source

I carry one guy put my house last year, this guy yarn how hin tori take be, he tell me about hin life, how him mama take die, he even dey cry sef say e no get where to stay for my church my i kan carry am put for my house give am food chop, help am find job make e no be like say he go just de sleep for house, make i cut the tori short this guy name na Ope he de work for one computer shop where i help find work and e de do well there i don de think say make i buy am phone before him disappear for where he dey work he carry two laptop wey worth N350,000 this same guy give my school daughter belle, nowhere we no find this guy go, we trace go hin family house for ibadan na wrong address hin give us, if no say him oga get the fear of God for heart he for arrest me.

I wan make una learn from my tori no be everybody laff give you get open for and make we de very careful who we go de carry join body waka and put for house society don hard gan so abeg make we de very careful o

Thanks for taking your time to go through my post, i really appreciate

i remain your humble and loyal boy @shunguystin

DQmRKgYYp1TzWmvqtnfbMSLZQSgUXinUxqyHyd39HZ8j7gx.gif

Sort:  

baba, it is painful but that should not change who you are, be good at all times trust me it pays...

Coin Marketplace

STEEM 0.31
TRX 0.11
JST 0.034
BTC 64852.72
ETH 3178.07
USDT 1.00
SBD 4.20