NAIJAPIDGIN HOTSEAT EPISODE 4 WITH EHIBOSS

in #naijapidgin6 years ago (edited)
Naijapidgin: Good morning my country people. This na another beautiful Saturday morning for we naijapidgin fm and as we dey do am every Saturday, today go be another OGBONGE Saturday as we get one of the big people for steemit for we naijapidgin hotseat show today. Body just dey sweet me anyhow as I dey here dey wait for am make he show face.

He don enter studio. Fine boy with no pimples. See as person fine like this. My people abeg make una ready to shout. The person wey dey with me here this morning na no other but baba himself @ehiboss. Abeg boss man, trowey salute for naijapidgin

IMG-20180414-WA0005.jpg
photo credit: mimy phone gallery

Ehiboss: My country pipo, I hail una. Even una wey dey gather dey follow me yarn, I hail una double o. My name na ehiboss and I gada tori for una today

Naijapidgin: Abeg boss you fit allow me hug you small? E don tey wey e dey hungry me.

Ehiboss: Chai, hug is allowed o, but na wetin fit follow I dey fear o...

Naijapidgin: Hehehe. No fear boss. na on behalf of naijapidgin I hug you. I go cherish this one for life. Stands and hugs

Naijapidgin: Okay so tell us abeg, who be @ehiboss.

Ehiboss: Ehiboss na one troublesome somebody o...him na lover, him no sabi fight. Him grow up as Irabor Daniel, but na for steemit him change name to ehiboss. I no fit talk all my mata here, book go too full o. But him na business man too and him na curator too..no vex how I take combine my tori, I no get myself small

Naijapidgin: Oh wow. Na for naijapidgin people first know your real name . Abeg wait make I dance small💃🏻💃🏻💃🏻. Mr Daniel the love. Okay o. @ehiboss now wey we don know your name, abeg tell us how you take join steemit and since you join, steemit don change your life? How the journey be?

Ehiboss: My waka for steemit get k leg small. Na one of my guy like that na hin carry me enter o. I first sabi steemit for 2016 but I bin think say na scam. Na when I research am na him I know say na true true something o. Kai na so I take miss better sp o. Steemit epp me start some of my plans sha, before then I don dey do somethings sha. But steemit don make me meet people and learn plenty things.

Naijapidgin: As e be now, you get plans to leave steemit?

Ehiboss: Well I loyal to steem(it) sha. Different people don try poach me for different blockchains but God pass devil. Lata lata I fik give small space for the younger generation because my company sef go need attention but na steem gum me for now, work still plenty for hia. Make I leave am at dat.

Naijapidgin: Hmm. Okay o. You say Steem hold you for here. Recently price of steem just dey match SBD anyhow. Wetin make am be like that? You go advise make people invest for cryptocurrency?

Ehiboss: Make I yarn you true true, crypto matter na long term tori o. If you invest now, later you go buy Ferrari like how Davido talk am, but abeg o, no go do gamble with your money. Better area dey like steem, chook your money dia o. The price dey dance shaku shaku because sell order plenty pass buy, another thing, people no dey gree invest for now because dia fear fear too plenty. Na bad belle dem dey cause the fear sha. But steem na asset, im go rise, sbd na either fiat material or future steem material.

Naijapidgin: This information wey you just give us now na ogbonge information. We no fit see am anywhere buy. Una hear am? Make you no fear Dem bad Belle people. Carry your money shook for steem because na asset. No go gamble for cryptocurrency. Abi boss no be so you yarn am?

Ehiboss: Na so o

Naijapidgin: Make we dey progress small small. Boss recently everywhere we dey hear people dey talk about SMT and EOS. They go say buy no buy, SMT do e no do. these terms e dey confuse people and many of us no understand wetin Dem mean so dey say make I ask you make you shine Torchlight for am small for us abeg.

Ehiboss: SMT na the ogbonge plan for now wey steem wan take barb some other coins dada. With that thing eh, you sef fit empower communities to do better for people. Anybody fit reason their own token take do better thing. No worry, Zuckerberg sef go fear fear, him sef go mara join the SMT train. As for EOS, I no fit talk much about am except say na separate coin too. But right now ehn, na steem I sabi o

Naijapidgin: So SMT and EOS which one strong pass?

Ehiboss: Na two different things dem be o. One na like subdivision of steem, the other na another coin on it's own o. EOS na wetin we dey call altcoin like steem, neo and the rest.

Naijapidgin: Okay. People fit still ask you about this matter for comment but another one dey wey we want know. This air wey dey drop everywhere abeg wetin e be?

Ehiboss: Airdrop na awoof of all those altcoins way dem wan launch. Na just to boost morale say dem mean business o. But see ehn, if you jam better one ehn, you tori go enter gear two o.

Naijapidgin: So make we dey do anyone wey we see?

Ehiboss: Yes and no. First of all ehn, no be all go pay. Secondly, no go drop wetin dem dey call your keys o. Dem fit tiff the small change wey you gather for wallet o. Most go require better erc 20 compatible wallet o. So basically, shine ya eye. Na only wallet address concern them o.

Naijapidgin: You do well tell us the secret. Make man pikin no go dey hustle another man pikin go run him race. You do well.

Ehen as e dey hot boss (smiles), they just send this one in now and they say make I ask you say, (clears throat), why you no want organize contest for

Ehiboss: Plenty contest dey ground already nao. My job na to support no be to con put sand sand for people garri. Na make others grow be the koko o.

Naijapidgin:But we want your own contest now. Boss just dey laugh for here, he no want answer. Nothing spoil. We believe say soon he go organise one for us sha.

Ehiboss: Maybe o

Naijapidgin: Unto the next matter, we know say you meet your Venus as you dey call am before steemit. Since you join steemit, e don affect una love?

Ehiboss: Well, (rubs hands together) our love dey gidigbam. Time dey for steemit and her own time with me sef dey. Like today now, I silence all my gadgets because na she get my time that time. To find money na good thing but if you gada money and love dey miss, na wash o. She important pass the money.

Naijapidgin: Wow. This love strong o. Men una hear am. To find money good but if you had money and love dey miss na wash. So abeg make una follow @ehiboss footstep o.

With this one we don come to the end of this our naijapidgin hotseat with @ehiboss. Boss dey chew pidgin no be small but before we go, e get three things wey you go do for me sharp sharp

Ehiboss: I dey hia

Naijapidgin: Abeg tell us how you take come about that name @ehiboss?

Ehiboss: In a way, one part na abbreviation of my real name, the other part na dey complicated. But all na wetin dem give me sha.

Naijapidgin: And you no want tell us the two names wey you combine? *Smiles

Ehiboss: No be name wey I dey like tell everybody. Na only few people wey close to me sabi am laughing

Naijapidgin: Na wa. This one don pass naijapidgin hand but nothing spoil. Oya shout out give three people for steemit make Dem still know say you dey naijapidgin hotseat.

Ehiboss: You know say na mimy I go first hail...oya @mimy I love you scarra o...I go hail @destinysaid, I confuse if him be man or woman again laughing

Okay last last na one stupid goat wey dem name @illuminatus na him be my last victim, woman no go kill am o

Naijapidgin:no be small thing. I sure dem go run reach here. Boss lass lass, translate for Queen's English "this ogbono soup draw well well"

Ehiboss: You wan spoil my career ba? God pass you. Na draw we go end this matter.

Naijapidgin: laughing boss, you no even make attempt. Okay o. Na assignment wey naijapidgin don give you. You go bless who answer am for you for comment o

We don come to the end of another exciting episode of naijapidgin hotseat with @ehiboss. If you miss am, you miss no be small. @ehiboss you do us well honour us come for we show. Hope you enjoy am wella? I no want leave you but we no get choice but before you go, any last word for naijapidgin people?

Ehiboss: Una head dey there, make una no stop o.

IMG-20180414-WA0000.jpgphoto credit: mimy phone gallery

Naijapidgin: make una no stop. Today own don meet us for here. Una do well as una follow us Tanda listen to this interview. Until next week wey we go come una way again, make una dey upvote, dey comment and dey reesteem our post.

Na @zizymena run this matter for naijapidgin and na @mittymartz post am

IMG_20180319_092844_398.jpg
Na @mittymartz design this avatar!

Sort:  

Smiles. You guys are really trying with this interview, @naijapidgin self-dey waka upandown dey spot everyone to get something out.
Its absolutely great. Good to hear from ehiboss from your saturday episode..... Una weldon ohh. I hail oh .

Shout out to all Naija pipu here.
@bollutech

Wow @ehiboss is Irabor Daniel how amazing damn now I am enjoying this episode, omg naso @ehiboss funny reach the price of steem dey dance shaku shaku oboy burst my brains.
Mehn I love wetin I read for here jare na .@naijapidgin win am abeg tell Ehiboss make him organize hin own contest and support people wey de use @genesisproject tag for steemit we miss hin love like kilode🙁🙁.
This one nah obonge show jare.
Chop knuckles @mimy / @ehiboss una love strong.

@naijapidgin i hail oo..i throway salute @ehiboss
E go as hot seat dey with @ehiboss. To God, i never see am before, i just dey hear say im be great set of steemian from @eurogee at least now he don share some things with us..
But e get one question way i wan ask, me way be minnow, watin be d advice boss @ehiboss fit give me may i use for steemit, concerning growing on steemit, because sometimes i just dy tired and discouraged...abeg i go appreciate am if i get small yan about am...i know say everyone go get there

Una guys don hear am finish o ehiboss don talk am say no be money everytime still get time for love too
Naijapidgin una too gbaski

Your own pidgin na from heaven, chai... See as you dey chew pidgin like gum... U too una weldon oh

Lol
Thank u o
Na so i see am

@Naijapidgin i hail una, una do well oh say u carry @ehiboss come studio. This episode go well and funny no be small. We don still hear one or two based on the steemit matter. Love na good thing oh :) Una do well 🙌

I hail everybody for Naijapidgin.
hotseat Na one of the best Naijapidgin show ever.
@ogoowinner weldone, the CEO I hail u..
@Zizymena you too much.
I know say Na only that love part we girls go take note of.
make una also know say, if money no dey una go still tear race. @ehiboss you be real boss

Una sef go fia fear...

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

Ahhh I enjoyed this die i hail all of Una oo sorry sey i come late na network

This is indeed very revealing! I enjoyed every bit of it. @ehiboss is indeed very humble.

Coin Marketplace

STEEM 0.24
TRX 0.11
JST 0.031
BTC 60936.15
ETH 2921.43
USDT 1.00
SBD 3.70