NAIJAPIDGIN HOT SEAT WITH @GLOGLO- EPISODE 7

in #naijapidgin6 years ago

Naijapidgin: Dancing manya by wizkid My people my people una welcome to another ogbonge episode for our Saturday morning show wey we dey call naija hotseat. God morning to all of una. We dey hail all of una wey tune in to this our episode 7! Una don try, make una clap for yourself.. If you miss the last episode, na our oga @destinysaid sit down for this hot seat and we enjoy am well well. Today, na our very own beautiful lady dey for studio

Abeg make una join me as I dey welcome @gloglo, the beautiful, friendly lady wey we get for Steemit to our show today. @gloglo welcome, greet our people, make dem hear your voice.

@gloglo: My name na @gloglo and I dey hail all of my better people wey stand tanda for our ogbonge steemit. I greet all of una wey dey appreciate the small work wey I dey do for here. I use the same hand greet naijapidgin wey dey rep us for here based on logistics.

@naijapidgin: AHH based on logistics! See as you dey shine today! Ahh, this your smile eh, e fit burst person braino.

@gloglo: Hahaha... na God handiwork ooo. Na him dey make me shine like dis oo. I remember as I sick finish but still God dey. Lol.

@naijapidgin: Thank God say u don well, We dey happy say you join us today. Abeg we wan know who @gloglo be? Wetin be your full name and where you from come?

@gloglo: E dey totori me wella as I join una today. E been don tey wey I been wan come but body no well that time but now I give God all the praise. I don show...lol.
My real name na Gloria, I be full naija blood, from imo state, for eastern side.

@naijapidgin: Una don hear am abi? She be better naija babe, IBO blood for that matter.. So now we wan know, when you enter Steemit? How your journey be, wetin be the hardship and enjoyment wey you don get for Steemit?

@gloglo: I join steemit june 2016 and since that time till date my life don change wella. Hardship don dey, failure and even better enjoyment don dey for my steemit journey.

@naijapidgin: E get one time wey you talk say you just dey learn cryptocurrency. You know say you don tey for Steemit, why e be say na now wey you dey learn Cryptocurrency?

@gloglo: Hahaha. Cryptos? Well everything get im time na wetin I believe. So I believe say e still never late for me.

@naijapidgin: Yesoo, everything na jeje. We dey follow wetin you dey write for your blog, e be like say you be relationship maga, wetin dey give you joy to write about relationship?

@gloglo: Lol... relationship maga? Hmmm... well I be one person wey love love.

@naijapidgin: Community na one sure thing wey fit help person for this Steemit, which community you fit advice newbies, even oldbies sef make dem join?

@gloglo: Na true you talk, as many communities don dey crop up, anyone wey suit anybody make him shook head for dia...lol. na the same progress we want for one another so I no believe anyone superior pass the order. All the forward movement towards growth.

@naijapidgin: Una don hear am? Make una shook head for anyone wey you like, all of dem dey good. We just dey wonder how people dey use this thing wey dem dey call flag button, we wan know wetin you think, make dem remove am abi make dem leave am for people wey sabi use am well?

@gloglo: Anywhere wey law dey e good make better preparation dey for people wey go want break that law... that is why we have that flag button. E go good make dem leave am like that so that order and discipline go dey.

@naijapidgin: We know say Steemit go make sense die if investors join, how you feel say we fit get investors from naija enter Steemit?

@gloglo: Na to continue to create to awareness so that people go see say this thing called steem na better way to get richer. Na gradual process but we go reach there.

@naijapidgin: Hmm, una hear richer ba? ahh una to like money? lol, make we dey do awareness o. Naija eh, we know dey carry last for meetups. You think say all these meetups dey help people to sabi this Steemit wella come grow?

@gloglo: Yes oo. So far meet ups don open people eyes for steemit and we no go drop am. Meet ups na even another sure way to improve steemit.

@naijapidgin: Meetups dey good oo, make una try dey go. We knowsay SP na gold for this place, how newbies go fit build their SP, make dem follow enjoy this platform..

@gloglo: My advise be say make newbies put eye down, I no say e no easy but e good to spend less and save more in one word believe and power up. Oyibo people say, " make hay while the sun shines" at least for the first 3 months any steem wey you realise from post, make them try use some if not all try power up so that their account go dey gain weight.

@naijapidgin: Aha! una hear wetin she talk abi? Make una no dey chop chop chop, make una try dey save o, na e sure pass. E just be us like say make this show no end, but wetin we go do? Before we close make we ask one more question, people dey join Steemit to make money, if the money no show, dey go just run.. Which advice you fit give newbies make dey no run, instead make dem stay contribute to the platform?

@gloglo: Newbies! newbies!! I no lie give una for here oo. Nothing good dey come easy. Na so e be for business, any better money dey take time. So make una just take life jeje and easy ... everything go better. Anything thing be say hard work dey pay oo. If you no work, you no go chop so make una no expect manner from heaven for steemit or anywhere.

@naijapidgin: This show sweet die, we dey enjoy your presence like say tomorrow no dey, wetin be your last words make we hear?

@gloglo: I wan tell una say, money no be everything, efit be say na person wey God wan use help you na him you suppose meet or steemit but because say money no dey come your way you run miss your life time opportunity. E good make una know say, patience and consistency na key to success.

@naijapidgin: Chai, u don chok us better word. We tuale for you o.. We happy say you come. Na here we draw our curtain. I know say una enjoy una self this morning, we get group for whatsapp where we dey yarn wella for pidgin, if you never join touch here

Na @nmalove run this one for @naijapidgin
DQmQkNYBpYh7mPEJV6KFqxCfneCsy8kYxgzH7Lg91z6zf7o.jpg
Na @mittymartz design this ogbonge avatar

Sort:  

I been dey hear about @gloglo but I never come across her, you do well madam

@gloglo, you make sense die, na patient I still chop to fit stay for steemit fa. E nor easy but na to d try d go na. @nmalove, thank you plenty for this better yarn.

@gloglo.... Keep glowing ma'am
@naijapidgin una well done o
@nmalove... Nothing do you, carry go.

@naijapidgin una good morning oo..
This episode make brain oo..
@gloglo nice to meet me you oo..
Your advice make brain, especially how you take advice us to dey save by powering up.
I go follow watin you talk by keying in.
Una thank you...

No be lie, @gloglo dey represent well. See as her skin texture dey smooth. Thanks for the newbie advice, e no easy for jeremiah not to talk of Isaiah. Everything na patience even our former presido Jonathan, na patience he take rule dis country. @gloglo carry dey go. Naijapidgin una three much. Buhari suppose declare public holiday for una

This episode make sense well well I enjoyam, hope unarmed go dey bringam every time, e sweet well well and de advice good for newbie if dem go hear and do am. @theheralds I don talk my own.

I don grab your advice na , thanks for coming , u do well @gloglo ....... @sola3097 na my own name

@naijapidgin I hail o. @gloglo you do well has you come untop this hot seat today.
Thank you for the advice.
Abeg make una where dey up there no relent to dey help newbies.

@naijapidgin una weludone my people, @gloglo you get beta yarn and we appreciate you. Oya chop kiss... Nnmmueehh!

Okk naija people una try for this one sha, i gret una double.

Coin Marketplace

STEEM 0.29
TRX 0.11
JST 0.033
BTC 63458.69
ETH 3084.37
USDT 1.00
SBD 3.99