NPC: WETIN FRIENDLY ENEMIES DON DO ME!!

in #npc7 years ago

IMG_20180124_094642.jpg
Bob Marley and African china talk say your worst enemy fit be your best friend and your best friend fit be your worst enemy. This talk talk no be lie and as @ogoowinner don say make we chook mouth for this matter, me sef go follow talk how friendly enemies don do strong thing.
Na so I been get one best friend for secondary school wey I think say like me. Na wetin make her come de close to my mumsy but MUMSY dey always warn me about her character but based on say we be friends I been no too send.
Na so this my friendly enemies carry matter wey I no do go report to mumsy based on say bobo wey de follow me been no like her even though she been like the bobo. As the thing set, na so I discharge her o. Ahbeg, make we de careful of friendly enemies o!!
I drop my pen here!!

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.16
JST 0.031
BTC 59013.49
ETH 2516.64
USDT 1.00
SBD 2.48