My Own Creed of Life for Pidgin Organized by @ogoowinner

in #npc7 years ago (edited)

i trowey ogbonge salute for this our mama @ogoowinner wey they always give me this opportunity make i dey talk wetin dey for my mind for we pidgin language. "you too much jare!!!!"
before i go yan my mind for wetin me i believe make we first understand wetin be creed

creed as oyinbo dictionary been talk am, nah anything wey you for believe, religion or faith,
many people get wetin dem believe and wetin dey work for them but me nah my own wey me believe be this

I belive say everybody get the right make them for the see am for wetin him sabi, make them hear am for em own idea, and make dem love because nah baba God nah him create all of us

I believe say baba God create all of us equal say nobody big pass anybody and nobody small pass the other person for say all of us nah em image

I believe say this obodo earth wey we dey even though as oyinbo tell us say nah small world E big soteey everybody go dey inside soteey the world go even come remain self

I believe say everybody dey special and get em own uniqueness wey no fit be the same with another person own.

I believe say everybody nah oga for were dem sabi there own thing that nah why we get footballer, musician and tailor.

I believe say the way make we for treat people nah so dem go treat me so i dey treat dem wella.

I believe say everybody get that devil wey dey inside am and that same angel dey inside am wey make am the act normal so me i go try anyhow e want be make i let the angel inside me win the devil.

I no go put hand for any matter or business wey go cause kasala for another person.

I go do one thing for this we earth wey at least them go take am the remember me if i no dey again.
I no go allow fear make e enter my body .

I no go be copy copy or follow follow for wetin other people the do rather nah tear rubber wey dem make me nah so i go be.

I believe say this life e get were all of us the go so i no go run with anybody so i no go allow myself enter for any competition with any body.

I no go allow say because say i dey jealous, or i dey envy anybody or because say i want get everything make e control wetin i dey do.

I believe say were we comot from, our religion and our social status no be anything but rather make wey for the help each other so that we go fit grow as nah baba God create all of us for we world.
I come belive say if i do all this things peace and joy go dey follow me any were i go

This nah all the things we me @oliverwilliams believe in

Rita-Dominic-NGTrends41-e1428042465920.jpg
image reference

As baba God go the help us for this matter and this life wey we dey
U5dr2k4hZ7ea2JFR1osnR5L9hkKVUJu.gif

Sort:  

Baba, ur head dey there

Na wa oooo efribody wan use pidgin scata d whole place now

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.027
BTC 60003.48
ETH 2309.22
USDT 1.00
SBD 2.49