Slave Encampment
Ma pipu my pipu how una dey, I trowey salute give una oooooooo.
Make una all welcome to our ogbonge naijapidgin blog..
Fellow steemians, how hustle? We thank God say market don dey green small small, it go beta very soon. @naijapidgin dey wish u a stressfree week ahead.
As today go be, @naijapidgin don carry one arising mata come ur domot. Make we yarn how slave trade don hit we countri. Hw slavery don sell away wetin God give us.
Wetin we mean by SLAVERY?
Slavery be one kind act wey be say individual go get freedom to buy, sell nd own oda individual as mean of property, dis one strong ooo. How person go own individual like him, wey be say na d same blood and bone.
It don show for history say our fore-father don suffer for dis slavery of a thing, been sold from camp to camp wey be say d work dem dey no easy.
Some implications dey for dis act wey don happen centuries ago
Wey include; loss of some culture and acts.
Make i leave dis mata, bcos say history don waka.
Make we talk about d recent one wey dey hot for ground.
Wetin we observe for d mata wey concern our country pipu wey libya hold as refugees, i believe say dis one na advance slavery, keeping pipu for camp in dis civilized world.
I no blame dem sha, because say as i dey see am, na greener pasture dem dey find.
Wetin we wan chuk mouth for today be;
How we fit stop dis slave trade of a thing?
make we no forget to the support our own naijapidgin so the we go fit the grow.
make we no forget to the support @naijapidgin with our upvote, comment and resteem.
nah @horlaide bring this one for us.
you fit join our WhatsApp group where e dey happen here
nah @martymitz give us the fine avarta
Good morning ma pipu dis mata na very serious one, ee dey vex me say some of our pipu dey still take the risk to go libya because from there ee dey easy to go other contri, to me na lazy and foolish pipu. No mata how d contri take bad reach wetin wan make pesin leave were dey born am say in dey find greener pasture especially this blessed contri wey our leaders don spoil, as a Nigerian ee no dope so make we try hustle well and right cause plenty tins wey pesin fit do wey go make am grow well for nigeria boku. Thank you, @naijapidgin all the way
I greet una too for naijapidgin
This na some ways to stop slave trade
One na to provide fund development for poor people cos poverty join wetin dey make people do am and also to dey do campaign against slave trade and make other developed countries work together to fight am because na everywhere e dey i hope i make sense small o
The only slave trade wey me know about now na the one wey dey go on for Libya.
.but weyti dey pain me be say that Libya dey preventable if we people go gree tanda for we country than to dey fine short cut to take enter ogbodo oyinbo
Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!
The only way to stop am na for government and private organisation create more job and make central bank orders banks to give accessible loan with lower interest rate. Make dem reduce the cost of running government and use am provide basic amenities and create room for self employment with little or no tax.
we fit stop dis slave trade if we become independent and hard-working. People way dey go over sea think say dey no dey work for that place, na lie oo. Them they work for their. Na people way dey fin quick money dey mustly fall victim if that thing.
My naija people if we work hard, God go bless our hustle because na him talk am say him go bless the fruit of our labour for bible. So no matter were you dey if God wants bless you, him go bless you.
And since government no fit give all of us job, the best thing na to be entrepreneur and from dey we fit independent, we no go dey look government face for job.
Na watin I get to contribute be that, una well done oo.