NAIJAPIDGIN HOTSEAT WITH @ADOORE-EU

in #naijapidgin6 years ago

IMG-20180715-WA0002.jpg
(Image source: what'sapp)

My country people I trowey ogbonge salute for unah o
How unah dey?

How unah take d how body for dis change wae d touchi everybody so?

I believe say body dey do fine inside cloth anywhere e dey
Anybody wey d read dis we post sooo…. I tell unah good morning gee most especially my Christian brothers and sisters dem I tell unah happy Sunday and to our Muslim people I wish unah well too.

Today nah start of another new week so I dey wish everybody better plus all d good thing wae d week go carry follow body come hmmm like play like play nah so july don d trek em own d go so,

e go better nah em dem d call am poor man prayer but anyhow yagayaga baba God past dem all so back to d matter wae we get today.

Today like we dey do am every other Sunday nah our hot seat show, if you no know wetin b hotseat nah where we dey interview steemians wey we believe say we fit learn one or two things from their experience come carry join we own.

Guest who we carry come today?

Nah the number 1 kitchen mama for we steemit her name nah @adoore-eu the mama chef herself, this woman d cook die and nah so she come decide to carry her cooking skill enter steemit where she come d feed everybody with her fine fine recipe

No b small thing o
Make e b say I come d talk to much.

Make you just follow us come we discord channel were e d happen and no forget to arrange your question for her too.
You no suppose miss am o I promise you say d show go hot die, as for me I dey dere live.

The time for the show nah 8pm [20:00GMT]
Venue: nah our discord channel
If you want sabi who she be, oya check her blog
Oya nah till time we go jam for d show

Nah @oliverwilliams bring dis one for us

Nah @mittymartz give us dis fine avarta
IMG_20180215_155325_695.jpg

Sort:  

I catch your salute and me sef throway one give you.

I duff ma cap for You ...twalle

Thanks guys, am honoured. I had fun

Oh, sorry. Una do well o, wey una take carry me come de show. De show bam and i happy well well.

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.16
JST 0.029
BTC 62555.95
ETH 2435.55
USDT 1.00
SBD 2.64