PIDGIN CHALLENGE-MY TWIN NA ONE SURE GUY WEY I DE ROLL WITH AND WHY I LIKE STEEMIT

in #npc7 years ago (edited)

As i de like this, i been de jonse when my man been yarn me about steemit, i been de feel like say na lie wey him de lie . As in how you go juz de write something and money go de comot come but as i come fully join,steemit epp my life i no go lie. Steemit help me run my mumsy birthday well well,no hold up for road. Steemit help me give my family one goat for new year amd steemit help me meet plenty guys and babes them.
i be twin o but some people no de sabi, one funny thing be say person fit jam the guy for road,them go think say na me and when them hail the guy,if him no respond well,dem go think say na me and them go say i too de form. E get one time like that wey one girl been see me for road,she think say i be my twin, omo the kind muscle wey the girl use hug me ehh, i shock like this, i come de wonder who be this person wey de hug me like say tommorow no de, i come ask am who she be, she come say why i de ask am that kind question, i tell the girl say i no sabi her,she vex, e no reach 5minutes, my twin waka come, omo as the girl see us, she shout, she come tell me make i no vex say she do me like that say na my twin she sabi.IMG_20180101_073626_886.jpg
Na me and my twin be this for this picture,shea we resemble?
When i been the year one for uni that year, e get one guy wey my twin been collect lab coat from use do practical and me like this been get practical too. So this guy been no sabi say i be twin, i just de do my practical, the guy just waka enter my lab come de tell me say him wan collect him lab coat back, i been shock like this ehh, baba which lab coat you wan collect? Him say de lab coat wey him give me now nowIMG_20170716_154626_651.jpg, i laugh ehh, i ask de guy wether person wey him give lab coat resemble me,him say na me,ok i tell am make him follow me, i carry the guy go show my twin wey him de do him own practical, omo the guy shout ehh say omo una resemble,say make we no do any bad thing make them no come mistake us o but we be good guys ,we no the do any bad thing.
I don end my yarn for here.
I the use this opportunity the thank @ogoowinner wey carry this pidgin challenge come. Babe you tight scatter.
I tuale for you joor.IMG_20170730_200834_444.jpg

Sort:  

Boss how far na? One of una suppose no get beerbeer na una resemble each other die

Hahahhahah baba e no for legit na

As in...... Too identical......abeg, make we give ourself code ooo..... If i jam u for road and i say (boss) and u no reply ( chairman), i b don know sey na ur twin i jam b dat. (Lol)

Hahahaha no wahala boss

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 54274.36
ETH 2279.16
USDT 1.00
SBD 2.33