MY NPC CHALLENGE- CREED OF LIFE

in #npc7 years ago (edited)

Hello my padi's I greet Una all.
I go like personally thank @ogoowinner for this kind insight on this Steemit I throway salute💯👍

Me wey be@marvelking i believe say everybody get right to be seen, heard and loved.

I believe say all humans dey equal.

I believe the world dey very big enough and e fit contain everbody

I believe say everyone be baba in at least one area of eim life.

I believe say everyone dey special and unique.

I concur say everyone get a beast and an angel inside of them. So I go try my best to tame the beast and ginger the angel.

I believe say race, religion and social status no be anything but the creation of contentious men in order to control others, cause strife and in-plant the supremacy mentality. So I choose to be "human first" before I am of any race, religion or class.

I go everly treat people as I go like make dem treat me.

I no go react to people based on who them be but who I wan make them to become.

I no go partake for any business or project wey go cause harm to another pesin

I go strive make i understand people and not judge them.

I no go allow envy, jealousy and greed make eim control my motives.

I go accomplish at least one notable thing for humanity before I comot for this earth

I go try my best to remain strong in the face of misfortune, grieves and sorrows.

I no go fit allow fear to intimidate me.

I no go allow any negative thought make eim occupy my mind, rather i go replace them jejely with peaceful and creative thoughts as soon as they come up because I know "thoughts dey powerful".

I go always be me, my original self and no photocopy of another. Or try to be pesin

I believe say I fit make a difference if I put in my best for any given task.

I believe say life na journey and not a race, so I no go permit myself enter into competition with anybody.

I believe in peace.

I believe in charity.

I believe in forgiveness.

I believe in love.

I believe in mercy.

I believe in justice for all.

I believe in human race.

I believe say I get duty to the rest of the universe to heal my emotional wounds

I believe say I get right to dissociate myself from people who go constantly indulge in abusive practices.

Me marvel i make the decision to "live" and not merely "exist".

image
Credit

Me wey be @marvelking go abide by this creed for the days of my life.

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.16
JST 0.030
BTC 63018.04
ETH 2471.67
USDT 1.00
SBD 2.68