THIS ONE NA GUIDE FOR NEWBIES - episode #1

in #education9 years ago

EPISODE 1.jpg

PIDGIN TUTORIALS

E get plenty breketeh things to see for this steemit every day o and e get many many things why person fit learn every day too. And plenty information day yakata, but some times, the informate dey dey very confusing and the grammar day too much sef..
.
so we wan come break am down for here, so every body fit read am and benefit from the plenty plenty informative.. So wetin every new born piken or new convert or new person for this steemit suppose sabi na d ogbonge way e day use work and also advice from them old and experienced steemians o..
.
To for know the small small shikini things wey dey important go help every new pelzin or steemian wey dey struggle..
.
Another problem na say when we bring people come join steemit because say we like steemit, them dey get plenty plenty kweshun, and even after them don join, them go still get plenty kweshun, and some times we no go fit ansa all of them wey we bring at once, so e dey good make we direct den to go read things wey go help them and wey no go confuse them..
.
We go divide this post to different parts so that everybody fit understand am sharp sharp..
.
**-Steemit Guides
-Reward Tutorials & Advice
-Do's and Don'ts on Steemit **
.
if you get any tips for us, no waste time o, just tell us sharp sharp.. tankiu

Sort:  


For more information, click here!!!!
Send minimum 0.100 SBD to bid for votes.


The Minnowhelper team is still looking for investors (Minimum 10 SP), if you are interested in this, read the conditions of how to invest click here!!!
ROI Calculator for Investors click here!!!

Coin Marketplace

STEEM 0.04
TRX 0.33
JST 0.103
BTC 64946.62
ETH 1941.30
USDT 1.00
SBD 0.37