FRIENDLY ENEMIES:A CONTEST BY AUNTY @OGOOWINNER
Hello my people how una dy,how body and happy sunday to all of una.I just dy come back from church na im my paddies dem @sirlahmjr,@wireless07,@ajibade yan me say e get one package way dy go for steemit wey aunty @ogoowinner organise.
My tori go like dis; e get one of my guy wey me and d guy close well well to d extent say people for my street even think say we be brothers.Me dey always share my things with d guy but d guy dy always find am hard to share hin things with me but me no dy care as per say i get d raba pass am .So one day i come back from shop i don con tire i come ask my padi wey him name na chibuzor say make him help me bring water make i shack na him my guy raise voice for me say make me no dy command am again and say him no b slave i come look d guy say wetin happen naso d guy tell me say i never see anything,I sha bone d thing enter room go sleep.The next day I wake up greet chibuzor but him no answer me I sha lock up come go hustle,as i come back from shop i come dy knock for gate but nobody answer i come dey call chibuzor for phone but my guy no pick call.One of my guys for street see me him come dey surprised to see me ,him come tell me say him think say i don travel with chibuzor him still tell me say e be like say chibuzor don sell d house and all of my property d tin pain me n up till today i never carry my korokoro eyes see chibuzor.
Naso d tin go my people and i go like thank my padis dem wey give me dis opportunity @sirlahmjr,@wireless07,@ajibade and also @rashford make i no still forget d person wey organise dis contest aunty @ogoowinner.
Congratulations @judeanth! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :
Click on any badge to view your own Board of Honor on SteemitBoard.
For more information about SteemitBoard, click here
If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word
STOP