Steemit don gimme money to build my tech startups.

in #npc6 years ago

@ogoowinner say we make yan the Steemit community why we like Steemit so na my own story be this.

I be website designer and I dey code too; so I bin don learn dem dey build website and internet related startup.

I get one website, the name na uduaa.com. D website dey similar to Jumia but na for people wey dey live for Uyo.

Capture.PNG

For the website u fit buy somtin pay with SBD; na the first of im kind for Naija.

Capture 2.PNG

I also get another one wey be travel website and d name na wakadupe.com

wakadupe screenshot.PNG

You fit find beta beta travel deals for the website, beta travel experiences, hotels, etc.

If no be for Steemit, you no for even see those websites dem becus I bin dey owe hosting. I no even get money to go see person help am set up im store for the Uduaa website or list hotel or travel spot for Wakadupe but now I fit do all those tins finish.

In fact, this weekend, Uduaa & Wakadupe dey sponsor one Steemit event like that (na surprise I no go mention d event).

Steemit don too try for me make una help me thank @ned for this platform and @ogoowinner for this beta contest wey she sama Naija people.

Na only beta things go do dey reach us now & forever.

Coin Marketplace

STEEM 0.27
TRX 0.11
JST 0.030
BTC 68362.67
ETH 3798.22
USDT 1.00
SBD 3.49