The Beta Beta Tinz Steemit Don Do For My Life (@ogoowinners Pidgin Challenge)

in #npc7 years ago

Una Good evening my country pipu for Naija, na una I dey write this article for ooo as I sabi say if dem no born you for Naija or u no be Naija blood, u no go fit understand wetyn I dey talk so. Make una first helep me throway double twuale🙆🙆🙆🙋🙋🙋 for @ogoowinners wey use her head to think dis kain tyn, baba God go sama u wit blessing aka ń chawa (hand of blessing) for dis cha cha new year.

download.jpeg
Image

I bin don dey waka kúrú kéré waká 4 steemit say make I fín suntyn wey I go fit use freestyle to talk about am, na him I con see @annieben bin dey post pidgin. I hapi die wen I see am and sharply, I nò dull am, na him I carry my paper folo my biro dey write dis tyn wey dey totori my belle.

Make I talk tru, I no fit count wetyn Steemit don do for me but I go talk small. I don become d Chairman for my male and pale house now as I dey drop small small change 😀😀😀 for dier pocket wen dem need any change. 4 my younger ones, I be die small god now ooo, dem respect me pass anytyn unto say Steemit don sama me wit money to dey helep my siblings.

Since I don waka join steemit, I fit read anytyn readable cus inspiration fit come from wetyn I dey read, make I use am do topic wey I go write untop. Even for my house, my neighbors don dey call me professor John Bull cus d way I dey read dis days, aswear u go fear 😱 😱 😱 .

Anoda tyn be say, I don know many pipu for here, even the pipu for obodo òyìnbó, dem don dey folo me talk, my broda dey tink sey I don turn yahoo yahoo.. 😀 😀 😀...

See ehn, if I say my I dey kwantinue to dey write, una no go slip reach tmrw, make I just leave tory and vamoose comot for dis place.

I know sey una lik as una dey read dis my tory wey I dey yarn una but who talk say una no fit folo waka write too. Wetyn u go do na small tyn, make u just press the link wey I go drop 4 the bottom of dis tyn wey I dey write. Abeg make una no spoil d fun ooo... 😀 😁 😂... My belle dey pepper me wit laughter abeg, d one wey I write don do. 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀 😀.

Make u just press dis link, so u go for fit sabi wetyn u go write.. 👍👍👍

https://steemit.com/npc/@ogoowinner/naija-pidgin-challenge-make-una-tell-us-why-una-like-steemit

Coin Marketplace

STEEM 0.20
TRX 0.13
JST 0.030
BTC 67383.45
ETH 3525.45
USDT 1.00
SBD 2.70