NIGERIA PIDGIN CONTEST....#WETIN FRIENDLY ENEMY DON DO ME.

in #npc7 years ago (edited)

IMG_20180121_122741.jpg
I don cum again for another ogbonge edition of dis Nigeria Pidgin contest. For today's edition, I go dey yarn una on wetin friendly enemy don do me, but before I go start, I go like throwey salute to my sister from another mother @ogoowinner wey talk say make I follow participate for dis contest, my sister tuwale for you ooo!!!

Our people dey talk say, enemy wey you dey see, beta pass dey one, wey you no dey see. But me don reason'am say both dey one wey you dey see, and dey one wey you no dey, no one beta.

Na so e happen oo, when I dey secondary school, when boys still dey chop for flesh, (when me neva give my life to Jesus Christ). E get this fine baby wey me with'am dey rappor wel,wel. I like this girl sotey come reach dey level wey be say I fit do anything for'am.

Dey love dey too strong, wey be say I even dey promise'am say even if na die self I fit die for'am, so far as e go make'am happy. Make I no lie dey girl too fine and as her beauty dey scatter my head dat time, I fit fight anybodi wey try near her to woo her.

So e get dis my guy emeka by name, wey me with'am dey follow go dey visit'am every weekend. I soo much trust emeka and na him be only guy wey be say, if he dey with dat my girl, I no dey shiver. A times if we get quarrel na emeka dey settle us.

So na him ooo! One day we dey for school, and dat day I no carry money come school and no be lie. So as we comot for break, na him my girl run come meet me say make I give'am money make she buy ice-cream, hmmmm! I come tell'am say I no carry money come school, like play like play, she come frown face. So I come ask'am say, na because say I no give you money to buy ice-cream na e' make you dey frown face for me, but I don dey give you money since the day wey you become my girlfriend, wey even pass to buy both ice-cream and dey seller.

Na so she begin dey pala, say I think say she no no say I don plan leave'am follow another girl, abi I think say she no no dey girl wey I dey woo naw. Omo na him my eyes come red ooo, she bark finish she come tell me say she no blame me, say she been dey waste her time dey think say I be beta person, say na naw she even realize say my friend emeka dey trustworthy pass me, say if no be him, she for no even no say I no dey ready to befriend'am.

Omo, my head nearly knock dat day, I come dey ask myself, wetin I do emeka wey make'am do me this kai thing? Emeka na my manchi wey I dey tell everything, wetin make'am gather mind do me this kai thing, na wetin I don no.

For one week, I no get myself, emeka self no even dey come my place again. So na after three weeks, na him I come dey hear say my girl with emeka don dey rappor, chai!!! This one na him finish me kpata-kpata. I rush go emeka dem house, make I go ask 'am weda wetin I dey hear na true, my brothers and sisters, I reach emeka house come see my girlfriend der, na him I fainted, na only God knows how I take survive, na dey first minute wey I open my eyes,na him I forbid emeka, na friendly enemy he be.

Thanks for reading;
Still on Nigeria pidgin contest, dey picture wey I put na for One day Enugu state I snap'am.

Upvote/comment, resteem and follow @frank4jesus.

Sort:  

Na so men dem just dey eff up sometimes.

Even sista carry her own misdo add am. How you go fashi man over ice cream? Emeka come rush tp grab his own copy.

That one dey sha, na so d tin dey be. At least e don reach say you no dey rappor with Emeka again, free space dey for beta tins.

But on a low key sha...how you no go get money for simple ice cream??

In fact, go kneel down first.

Hahahahaha!!!
You for ask me dey kai ice-cream wey she wan buy..

Hahahahaha!!!
You for ask me dey kai ice-cream wey she wan buy..

Woman wahala na wetin dey break so many friendships but no be woman cause am, na wetin man do in the name of woman dey cause the wahala.

Although the girl sef, fashi dat tin, no be ice-cream dey worry am, she just carry dat one do eye service; for her mind, she don comot eye for your side already. Na to turn am into reality wey she take do dat nonsense wey she do. You lucky sef, she do you favour as she comot your life so.

Coin Marketplace

STEEM 0.21
TRX 0.25
JST 0.038
BTC 96989.50
ETH 3378.64
USDT 1.00
SBD 3.23