Naija pidgin challenge : wetin make I gbadun steemit

in #npc7 years ago

IMG_20180115_043858_686.JPG
Image source: Pinterest.com

The person wey una carry eye see there na our main man late Fela Kuti one of our Afro beat pioneer,human right activist.

Steemam na wetin me I wan call this small place for my pidgin wey oyibo bin don name am steemit .

Make I waka go fiup to the main matter wey carry me come dis place, and na him be "the reason wey make I like this my steemam"

Make I yarn my own
de money na de main tin O
Na money be de number one tin wey make me gbadun am bcoz I no for like come sitdon here and hustle wen the bar no De enter
The place de give me small bar
Make I take hold body small
E make me sabi wetin our fathers bin de mean by time na money

Another tin wey make I sampe am na bcoz e Don help my olodo brain to de get some kind stories and information wey fit help me Somwhere for this life wey we de live

The place come make me believe say I get small brain to de also give people information,

For this place na him I con sabi say we suppose help our brothers and sisters to grow like us
I fit make example with dat tin wey dem De call upvoting.

This steemam make me sabi say Fine fine people de for this our obodo world and I con even meet some of them for this place

E con do make I sabi say I no suppose stop the tin wey I sabi well well and that na wetin dem De call consistency

For this place I Don sabi how to chat well with people and how to take talk so dat people no go vex
Na wetin make me like steemam be this o

Sort:  

Corret gai! 👍👍 Tuale

This is the best post on Steemit. I gave you a vote now, ya heard?

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 57978.54
ETH 2283.22
USDT 1.00
SBD 2.47