Naija Pidgin Challenge : Weytin Friendly Enemies don do me -

in #npc7 years ago

This matter wey @ogoowinner bring up na serious gbese wey boku full ground, people don kpai as diz matter na strong something wey fit break heart. ... My tori na like dz en take play...
I carry my nyash, enter villa 28th December, say make i go see my people wey i don leave for sometime... Devil wey be wan punish make am sotey, to enter bank drop kudi pass worldwar 3, so i kukuma carry money wey suppose be for my school fees and shikini change wey i collect from Nairabet enter villa...
As tradition demands, as i drop leg commot for villa, i gatz buy one or two bottles for guys wey dey around, so as night reach, i carry guys commot.... As i don dey finish my Nairabet money, na him I tell guys say make we dey go... I no wan touch my school fees cash.. una know as things dey hard...
IMG-20161208-WA0001.jpg
As morning don reach, I say make i enter bank go drop school fees as i no trust myself as nwa aboy... Choi! My cash don stretch legs , en don match commot from my bag... I no fit cryIMG-20170117-WA0001.jpg

Na so so console them dey console me
As things don red, I gatz tell dem say I dey go juju to go look for mirror who do me this kain thing, and Ifa know say i for go... Before i bath finish to commot, o boyee, i see 40k out of the 50k wey don miss... E shock me die.. I kukuma respect myself, collect my 40k commot, enter car, go back my papa house for town... I caanot kill myself for villa
IMG-20170125-WA0006.jpg

Coin Marketplace

STEEM 0.24
TRX 0.26
JST 0.041
BTC 98706.68
ETH 3491.96
USDT 1.00
SBD 3.39