MAMA AFRIKA (A poem by @bat-junior). Pidgin version
She fine no be small
She be good mama and her heart no small
She like her people wella even the ones wey small
Her name na Afrika, she no go ignore your call.
I be black person, shey you dey hear
Na my mama born me and I no go fear
She teach me how I go dey take face my fear
Her name na Afrika, she no go ignore your call.
Inside all the pikin her mama born, na she fine pass
Inside all the pikin her mama born, na she old pass
All of them dey jealous her because na she strong pass
If we bet on top her matter, na she go sure pass
Her name na Afrika, she no go ignore your call.