Naija Pidgin Challenge: why I like steemit

in #npc7 years ago (edited)


Image Source
Uniben Main Gate

MAKE I YAN WHY STEEMIT DEY MAKE ME JOLLIFICATE

Steemit dey jones me ooo, chaii unto area boy wey(Warri) I be, we don de subscribe de press paino for long but still no shows, so when oshare yan me steemit, i be like "oshare you don start again" but nor be so steemit dey deliver steady, but based on say i don de run tinz online since i still de ask for evidence before i involve pit, you know how the thing go. So oshare come show me evidence omo na so quick quick i involve, make express for nor pass me.

Since I galant for this platform, I don make waves in many ways, this nor be eze goes to school or chike and the river, this na the koko, steemit nor be like all those ponzi when paul gots pay peter, because the day paul nor get that means no show for peter, and that one mean say kasala don gas be that.

Since I make steemit my papa compound i don de clean, my thoughts don improve unto say na correct guys and chokos i come de parol with, them dey give me formats all the time to make sure say I nor slack for back.

And to come top the mata kpatakpata steemit don give me avenue to show myself and shakara based on say I fit yan about waitn de sweet me, or waitn de pain me, show my talents, infact anything wey sweet you, nor be say shoot bird mama fly, check am out now, we get different places for those when sabi write, those when sabi sing, those wen sabi dance, even sports balance for the matter,na food that one dey too, na culture e involve for the matter, abeg if i begin count scores we nor go piante comot here,so make i match break for here.

If you know say i yan your mind and you like all waitn i don spit for here,make you show your boy love cause my battery low for this side.

UPVOTE || COMMENT || RESTEEM

One love my people.

Sort:  

This yan Dey sweet my belle... Make we continue on this level my oga

Hahaha, you know every...Tuale baba

Ahhhh
That kind thing. Guy flex

Baba you correct.

Baba you correct.

Correct baba.

Congratulations! This post has been upvoted from the communal account, @minnowsupport, by admiralsp from the Minnow Support Project. It's a witness project run by aggroed, ausbitbank, teamsteem, theprophet0, someguy123, neoxian, followbtcnews, and netuoso. The goal is to help Steemit grow by supporting Minnows. Please find us at the Peace, Abundance, and Liberty Network (PALnet) Discord Channel. It's a completely public and open space to all members of the Steemit community who voluntarily choose to be there.

If you would like to delegate to the Minnow Support Project you can do so by clicking on the following links: 50SP, 100SP, 250SP, 500SP, 1000SP, 5000SP.
Be sure to leave at least 50SP undelegated on your account.

Coin Marketplace

STEEM 0.17
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 59774.28
ETH 2422.19
USDT 1.00
SBD 2.44